Music Video
Music Video
Credits
PERFORMING ARTISTS
Erigga
Vocals
COMPOSITION & LYRICS
erhiga agariubie
Songwriter
PRODUCTION & ENGINEERING
Josiah Kenneth Omage
Producer
Lyrics
[Intro]
Omo you know say this life enh?
Just get the way wey e take be
No be according to size dem take dey share am reach you, mehn
You no understand?
We know where we dey come from
Aii, my name na Erigga Paper Boi, mehn
Congratulations
[Chorus]
Glasses in the air for us when don try
Growing up no easy for us
Na we be those children when dey trek go school
But now we dey drive dey drop our pikin for school
Glasses in the air for us, multiple streams of income, from mumu to boss
Glasses in the air for us when no give up
Glasses in the air for us
[Verse 1]
I know how it feels to be this broke
Inside jungle dey beg, may you see smoke
If you get, you for buy nah
Hunger dey kpai am, sapa dey tell am
Remember when dey lie say pile get money?
For us to fit in, cos all their pile get money
Enter their house dey wonder, see as their parlor big
But today I no remember how their parlor be
One of my guy mile warn me, where I take fear my head
She say "Erigga, why you dey wear only one shirt
Dey come this house, from today, no near that gate"
Na money when man no get, mama no go fit relate
If your papa na big man, you no know wetin God don do for you
Many people hang for waiting
So church dey full, pastors dey cash out big time
The sign of the time, dey burn money for anointing
[Chorus]
Glasses in the air for us when don try
Growing up no easy for us
Na we be those children when dey trek go school
But now we dey drive dey drop our pikin for school
Glasses in the air for us, multiple streams of income, from mumu to boss
Glasses in the air for us when no give up
Glasses in the air for us
[Verse 2]
Mindset of the average trenches pikin
Na wetin to chop, wetin concern am with vacation?
But today, na still we the same we trenches pikin
Their own dey beg to carry them go on vacation
The distance between you and success no far
Na you no wan waka fast, dey follow mumu crew
Below the poverty line, wetin you wan make I do?
The odds against us, chances na 0.2
Reality don dey call you, answer, big man
For small money, see the way you spoil life throway
Life precious, no use am play gamble, big man
Na why two of us no fit waka go reach today
Toast to the nights when dem say make who no get shut up
Lock up, no talk, wetin you wan contribute?
Bag of nothing plus bag of nothing equals to nothing
Na why we find money, like if you move we shoot
[Chorus]
Glasses in the air for us when don try
Growing up no easy for us
Na we be those children when dey trek go school
But now we dey drive dey drop our pikin for school
Glasses in the air for us, multiple streams of income, from mumu to boss
Glasses in the air for us when no give up
Glasses in the air for us
[Outro]
Omo make I tell you something enh
You see this game called life, you dey win, my brother man
Anything you do, you dey win but na you go decide the kind win you wan win
Because your brain dey wired to win, you no understand?
Check am out nah, if you tell yourself say you wan make money, you go make money
If you tell yourself say you no wan make money, so far you believe am, you no go make money, na so life be
Toast to the night when be say nothing dey to eat
But right now I dey one big buffet now, I no know wetin to eat
Day break everywhere burst mehn, family time, baby
Make we go chop
Written by: erhiga agariubie