Lirik

Bad Bella dey wish me bad say make I fall
But I dey fall for greatness
I say thank you baba God
I get plenty money my life dey on soft
Dem get last card but omo I check up
Dem want to run my race but dem no fit at all
Dem want to carry my weight dem no fit at all
No be cho cho cho we dey show workings On God
We go dey give them give them give them
Till thy kingdom come
Only money wey dey turn me on
Peace of mind I get am e surplus
You carry wahala come sharply I go run
Jeje me I dey go make dem no try me at all
Oh my brother I dey for you
When e sup for you you been flex me too
Make you let me know if e rough for you
If dem no send you me I dey for you
Oh my brother I dey for you
When e sup for you you been flex me too
Make you let me know if e rough for you
If dem no send you me I dey for you
Dem say I do this
Dem say I do that
Dem been be dey criticize
But I dey them say der father
I no know wetin dem want o
Der matter I dey use am smoke igbo
Sebi dem see when I dey hustle for money
All the night wey I been no sleep
When I dey online with my geees
Dem underrate but now dem overate
When I touchdown dem go feel am I must say
Plenty kele for my domot o ay yeah
Plenty money for my account o ah yeah
Plenty moto for my garage o ah yeah
Para para call me Don Pablo ah yeah
Oh baby make I chop your your gelato
Na double six if I roll my dice o
Money talk when I’m with my guys o
If no be money matter no dey buzz my phone
Oh my brother I dey for you
When e sup for you you been flex me too
Make you let me know if e rough for you
If dem no send you me I dey for you
Oh my brother I dey for you
When e sup for you you been flex me too
Make you let me know if e rough for you
If dem no send you me I dey for you
Written by: Orewale Adewale Mayowa
instagramSharePathic_arrow_out

Loading...