Créditos

INTERPRETAÇÃO
Fela Kuti
Fela Kuti
Vocais principais
COMPOSIÇÃO E LETRA
Fela Kuti
Fela Kuti
Composição
PRODUÇÃO E ENGENHARIA
Fela Kuti
Fela Kuti
Produção

Letra

Get away, fuck off, who are you?
Go and die, fuck away, get away, who are you?
Go and shit, you dey craze, I no craze
Fuck away, who are you, eh?
Na two people dey yab so
Na two people dey yab so
Where them dey yab, roforofo dey
Where them dey yab, roforofo dey
Two people dey yab
Crowd dey look
Roforofo dey
Wetin you go see?
Roforofo fight eh
Wetin you go hear?
Roforofo fight eh
If you dey among the crowd wey dey look
If you yourself dey among the crowd wey dey look
And your friend dey among the two wey dey yab
Tell am, tell am, tell am, tell am
Tell am make him no fight o
Make him no fight because Roforofo dey
Your friend don vex him don vex patapata, him no go hear
Your friend don vex him don vex patapata, him no go hear
By and by the fight go start
By and by them go fall for Roforofo o
Them face go be roforofo face
Them yansh go be roforofo yansh
Them body go be roforofo body
You no go know who your friend be
You no go fit help your friend just because roforofo dey
If you want help your friend Roforofo go rub for your face
If you want help your friend Roforofo go rub for your yansh
You don tell am before make him no fight o
Make him no fight because roforofo dey
Now listen to me now
Roforofo don change them
Them go look like twins
You no go know who be who
You no go know your friend from who
You don tell am before make him no fight o
Roforofo dey for there
Two people dey yab
Crowd dey look
Roforofo dey
Wetin you go see?
Roforofo fight eh!
Written by: Fela Kuti
instagramSharePathic_arrow_out

Loading...