Lyrics
Attention
Mark time
Salute
Standard at ease
Stand at aiit
Blackface
Ghetto Child
Trybunal
I go do all at once
All at once now wetin dey worry you
Ah Ah I fit faint oh
you say wetin
Abeg now I no d anything now
I go lock you up now
I go lock you up now
Abeg now Ahhh
Na so them take e oh carry us go prison oh
Before we know them tell we make we enter the back of the motor
We na do nothing and we still dey tell them Biko
We na do nothing but we still dey beg ie oh
Na so them take e oh carry us go prison oh
Before we know them tell we make we enter the back of the motor
We na do nothing and we still dey tell them Biko
we na do nothing but we still dey beg ie oh
Talking of my ups and downs with police eh ohh
And the yeye things wey dey happen for my country e oh
Everything I dey say believe me is nothing but the truth e oh
Take a look around and check am see if na lie I dey blow
One thing one day
As we travel dey come from Uyo
we reach e park buy e ticket ready to board e motor
we move small
small oh
motor spoil for road oh
I sight one joint decide to enter make I sip some dogo
Them wan move oh
Move oh
My phone start to dey ring oh
I start to talk to shayo dey tell am say the motor go fit to delay oh
I never even off my phone oh
Na him dey extort come oh
Yekpa
E slam my phone e cork how gun e stand e bone oh
E say we be armed robber oh
EtenEyen' No sari say phone no be gun oh
Them call them station oh like twenty police show
Live show
Na so them take e oh carry us go prison oh
Before we know them tell we make we enter the back of the motor
We na do nothing and we still dey tell them Biko
we na do nothing but we still dey beg ie oh
Na so them take e oh carry us go prison oh
Before we know them tell we make we enter the back of the motor
We na do nothing and we still dey tell them Biko
we na do nothing but we still dey beg ie oh
One Tuesday afternoon
sixth or seventh of June
I get e show for Muson Centre so I say make I zoom
Zoom Zoom Yekpa
My guy I start my motor
I pass mile two I pass orile na him I hit Akpangbo
Motor line for front oh
I say make I look oh
And as I look wetin I see '
I see some mopo
with them uniform and them gun
them begin to dey search the cars one by one
when e reach my turn the mopo say hold up wait
Your inner light
Your particulars
Your license
The shirt wey you wear the proof of ownership
Your MOT your ECMR
Insurance for the radio and speakers wey you put for your car
oya park well
why your eye swell
E don smoke now
That I can tell
Na so the mopo put me for cell
Come think say as a citizen man no go yell
E no gel
Na so them take e oh carry us go prison oh
Before we know them tell we make we enter the back of the motor
We na do nothing and we still dey tell them Biko
we na do nothing but we still dey beg ie oh
Na so them take e oh carry us go prison oh
Before we know them tell we make we enter the back of the motor
We na do nothing and we still dey tell them Biko
we na do nothing but we still dey beg ie oh
Oga officer easy with we
The roadblock nowadays don turn insanity
why oppress an innocentie and you say you no send if I be celebrity
Put your hand for corner say the people no go see
Police protection
Blackface kosi
Ah things no be like we dey see
E be like our country don dey drown for sea
Because
we still dey hang for bus
social amenities e no dey for us because
the big boys for Aso and rocks no give a damn if the poor man car no get shocks
as every thing dey go
The more and more wey the thing called corruption dey grow
tell me why e be like so
Embassy kiakia abeg na Yankee we dey go
Checking out
Na so them take e oh carry us go prison oh
Before we know them tell we make we enter the back of the motor
We na do nothing and we still dey tell them Biko
we na do nothing but we still dey beg ie oh
Na so them take e oh carry us go prison oh
Before we know them tell we make we enter the back of the motor
We na do nothing and we still dey tell them Biko
we na do nothing but we still dey beg ie oh
Written by: Ahmedu Augustine, Ahmedu Augustine Obiabo