album cover
PA¥ M€
album cover
00:05
02:00
00:00
02:17
Past 7 Days
PA¥ M€ was discovered most frequently at around 5 seconds into the song during the past week

Lyrics

[Verse 1]
Say my gbẹdu don dey play for speaker
All the kele don dey turn up
Ọmọ you no fit to whine my ****
All my **** dem dey gazo
All my **** wey dey garan
24/7 we dey ball up
O ya roll am make we tie up
wey the lighter make we spark up
Tell you say I be the baddest say you no know
Say you no know me
Been the baddest in game for a long time
This na true story
I dey live my life like e be a
Like e be movie
No dey joke when it comes to my paper
Say you gats pay me
[Chorus]
Ehn
You gotta pay me if you wan see me
No dey deal in naira, foreign currency
All day chasing paper me I no fit sleep
'cause wetin I go do if I no find money
Wetin I go tell mommy?
Since yesterday I dey find OT
Oluwa blessing don dey cover me
My **** make you no dey bother me
[Verse 2]
my **** make you no dey bother
Talk say I'm the baddest I no stutter
From Ikeja to Ojota
Ajẹpako no be ajẹbutter
I be their father
Independent ko si wahala
I no likey this your palava
Everytime ṣe make I pastey my aza
No change am for me you gats talk correct, ma pariwo
Ṣe you no dey see all the money full for Ghana must go
Abena baby take all money girl carry go
E no really matter I just got ten milli for a show
[Chorus]
Ehn
You gotta pay me if you wan see me
No dey deal in naira, foreign currency
All day chasing paper me I no fit sleep
'cause wetin I go do if I no find money
Wetin I go tell mommy?
Since yesterday I dey find OT
Oluwa blessing don dey cover me
My **** make you no dey bother me
Written by: Kaobichiadina Jesse Nwamba
instagramSharePathic_arrow_out􀆄 copy􀐅􀋲

Loading...