Songtexte

As you marry you don born pikin oo sharp sharp You come use am dey worry sister Nkechi You forget say na Jehovah dey give pikin oooo Funke Akindele na evidence ooo oo Mama and papa make una calm down ooo Una don love emeka forget brother Emma Because emeka get money pass Emmanuel oo God can bless any time eeh Abobi God can bless anybody Make you no look down on anybody As you dey see me so nobe my power Nobe my might eeeh Nobody special pass Abobi God can bless anybody (one time) Make you no look down on anybody (at all at all) As you dey see me so so Nobe my power Nobe my might eeh Nobody special pass You buy motor you come dey do inyanga You forget say life na turn by turn If e reach your turn brother make you jolly eeehh Life na turn by turn oo Nobody special pass The end PC lapez
Writer(s): 0, Ebuka Prince Phd Ejimonyeibe Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out