Paroles

Bottles up! put dem in the air Men dey talk, I know wetin I hear Live my life, like ion really care Cos when e burst When he burst (p_p_ple) W-w-when e burst When e burst When e burst, people dey delete Men go stab your back ask you why you dey bleed Their plan na to bury me but Erigga na seed Iffa dey yan my mind dem go say na weed So I keep my ish to myself, I don see am no need Cos at the end men go do wetin sweet dem But karma know their address charter keke meet dem Your man go hide stain your clothes becos he dey sell bleach To quensh you nor go hard am like benson swish Weda you play your piano or dey into music Make your money leave poor man with excuses The way my circle take small like okro muni Na beta pass, snake dere nor fit wound me I nor fit use my two legs test weda river deep Reduce the hennesy, iffa hear say liver cheap King of the South, nor dey binu for my leadership Enjoy the voyage, just take am say na symbal ship Bottles up! put dem in the air Men dey talk, I nor wetin i hear Live my life, like ion really care Cos when e burst, people dey delete (people dae delete) When he burst, people dey delete (people dae delete) When e burst, people dey delete (people dae delete) When e burst, people dey delete (people dae delete) When e burst (people dey del-) I just wan stay fresh like brand new shimmy Play with my money, burst your head with full remy Nothing you wan tell me About this street my guy Once you broke men men dey dismiss my guy Before my coffin drop, order one casket come Don P If benson dey bring like two packets come Stand untop of the clubhouse, girls dey go insane We dey come this life finish, na to go remain Three girls for my bed, two dey crush my rod Half bottle of hennesy follow my come from club One boyfriend dey call she save he name with love But she prefer to dey with me cos money dey involve Na mula dey rule the world, oko leave mathset My brother say na love, tha one na e mindset He bae dey cheat anyhow like baby wey dey purge He name nor be finidi so leave am make e deu judge Gen still dey on, AC still dey blow NEPA still dey knock, be like say men dey owe By pass the meter, Segun from Ejeba hood Forget this Lekki life, this Erigga you self you nor good Bottles up! put dem in the air Men dey talk, I know wetin I hear Live my life, like ion really care Cos when e burst, people dey delete (people dae delete) When e burst, people dey delete (people dae delete) When e burst, people dey delete (people dae delete) When e burst, people dey delete (people dae delete) When e burst (my brothers dey del-)
Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out