Lirik

Your worst enemy oh go be your best friend Every night and day we dey think our daily bread You never can tell who go be your best friend You never can tell when this world he go end Shey make we yarn about the one June 12 Wey be say them kill people before the 12 Abi na the one of Clifford Orji oh Cannibal man when dey chop man body oh Another one happen inside Ajegunle Burning and killing to become baale Oh, plenty woman wey carry belle Omoge, them make them begin they fear If I say O, you say P another man say C Omo na you sabi If I say O, you say P another man say C Omo na you sabi I say, "Them burn man" Them kill man oh for inside Ajegunle I say, "Them burn house" Them steal land oh for inside Ajegunle I say, "Them burn man" Them kill man oh for inside Ajegunle I say, "Them burn house" Them steal land oh for inside Ajegunle Something happen for inside Mile 12 Wey go make we all Nigerian come interfere Something happen for inside Mile 12 Wey go make we all Nigerian come interfere Nursery student wey dey go learn Omo na him them kill oh, make we no yarn Nursery one oh, wey dey go learn Omo na him them kill oh, make we no yarn Eh, we dey happy for democracy While some useless ones them dey demo dey craze Eh, we dey happy for democracy While some idiot ones them dey demo dey craze My brother, oh, na useless world Wey man go live and man go die go Eh, na useless world Wey man go live and man go die go I say, "Them burn man" Them kill man oh for inside Ajegunle I say, "Them burn house" Them steal land oh for inside Ajegunle I say, "Them burn man" Them kill man oh for inside Ajegunle I say, "Them burn house" Them steal land oh for inside Ajegunle After secondary school, my friend go Kaduna E go Kaduna, e go serve oga After 20 years him don dey serve oga Make e travel go village oh go see him papa Tell papa say him don become oga Tell mama say, "I don become oga" See papa finish enter Kaduna See mama finish enter e dey go Zamfara As my friend reach o, ife eme My brother go, ebelebe gbuo My friend reach o, ife eme My brother go, ebelebe gbuo Them carry trailer them land for our land Wetin we see, human dead body Wetin China see, human dead body Wetin my brother them see, human dead body When papa reach oh, see him pikin oh He halla say, "Ife eme" He halla say, "Ebelebe egbuo" Nwanem, ewo, ife eme I say, "Them burn man" Them kill man oh for inside Ajegunle I say, "Them burn house" Them steal land oh for inside Ajegunle I say, "Them burn man" Them kill man oh for inside Ajegunle I say, "They burn house" Them steal land oh for inside Ajegunle As it is a useless hood Wey man go live and man go die go Situation me tell you don unfold United me stand and divided we fall, I said As it is a useless hood Wey man go live and man go die go Situation me tell you don unfold United me stand and divided we fall, I said Oya sharia law, this na brand new one Sharia law, make una hear this one Sharia law, my God Oh, them say, woman and man no go sleep for one day Them say, woman and man no go eat for one plate Sotey, them say, we man we no go see woman face Ah say, whata gwan? Jah-Jah know say, we not do them wrong God know say we burn in exile No matter what they say, oh, China whata gwan tonight? Your worst enemy go be your best friend Every night and day we dey think our daily bread You never can tell who go be your best friend You never can tell when this world e go end Shey make we yarn about the one June 12 Wey be say them kill people before the 12 Abi na the one of Clifford Orji oh Cannibal man wey dey chop man body oh Another one happen inside Ajegunle Burning and killing to become baale Oh, plenty woman wey carry belle Omoge, them make them begin they fear If I say O, you say P another man say C Omo na you sabi If I say O, you say P another man say C Omo na you sabi I say, "Them burn man" Them kill man oh for inside Ajegunle I say, "They burn house" Them steal land oh for inside Ajegunle I say, "Them burn man" Them kill man oh for inside Ajegunle Them burn house Them steal land oh for inside Ajegunle
Writer(s): Trevor Duncan Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out