album cover
Area
2,355
Music
Area은(는) {albumName} 앨범에 수록된 곡으로 2026년 4월 30일일에 Kenney Boy에서 발매되었습니다.Area - Single
album cover
가장 인기 있는
지난 7일
01:10 - 01:25
Area은(는) 지난 주에 약 1 분 and 10 초 시점에에 가장 많이 검색된 곡입니다.
00:30
01:10
01:55
00:00
02:22

크레딧

실연 아티스트
Kenney Boy
Kenney Boy
보컬
작곡 및 작사
Kenney Boy
Kenney Boy
작곡가
프로덕션 및 엔지니어링
Olatunez
Olatunez
프로듀서

가사

Kenney boy
Omo this nyesco seh
I no fit impress you guy I hustle with pain
E no pass e don cast e go pass again
I believe say na grace everything na grace
I understand I still keep my juju incase
Everything shey dem talk say na vanity
E no fit withstand the weight of my gravity
Better k dolls wey go cause calamity
I wan talk something now now abeg allow me think
Who Dey diss me for here I wan hear your gist
Every gathering get leader who be your king
Who dey ginger you see me he no fit breathe
You don pressure yourself cause na me me you beef
Exercise your patience make I show you things
By the time we’re done you go feel the hit
We no touch am too much but dem burst he lip
Paralyze am gutter Cain am for street
Na money matter make Judas betray Jesus
I no fit sleep every night I dey fight demons
Pastor wey sheet for church go still preach sermon
I remember the days we Dey smoke carton
Verse 2
Area no get memory when it come to street
If I do good for you I go keep receipt
Evidence matter before you go pour me spit
Na money we dey catch, who dey catch feelings?
Blood see blood message blood no reply
Dem put blood on call blood press decline
If money na drug make e spoil my life
I go still do anything wey dey my mind
As you fuck up just know say the life dey turn
Your six pack and chest no concern my gun
I go pay evil with evil nothing go sup
Ehhh God! Why this Cana put me for talk
Who talk say make I leave everything to God?
When dem show me shege nobody fit talk
Fake update wey una take deceive us
Carry shoot na wetin dem take believe us
Pastor ask me how much money I pray for
As I tell am he halla blood of Jesus
Na once pastor call police say make them come
Next minute police hilux dey my front
Wahala!
Written by: Kenney Boy
instagramSharePathic_arrow_out􀆄 copy􀐅􀋲

Loading...