Teledysk

Kredyty

COMPOSITION & LYRICS
Ifeanyibema Onyebuchi Evans
Ifeanyibema Onyebuchi Evans
Songwriter

Tekst Utworu

Another Christmas don come outside for corner o For papa Nkechi meeting dem don carry money run Contribution woman her number no de go Now if you come my area dem de fight comot roof Cause mama Nkechi say she no fit do am with nama o If no be turkey or chicken everybody dey wahala o I taya oo Is this the birth of Jesus Christ? Wahala o Na Jesus dem born no be you dem born I taya ooooo Wahala ooooo Na Jesus them born nor be you them born For Jesus birthday nobody buy bible o Jesus birthday many girls carry belle For Jesus birthday iPhone cause quarrel Men sell property they just want to impress I taya o But the birthday no be do or die Wahala o If na beans I get I chop am I taya o Is this the birth of Jesus Christ? Wahala o Na Jesus dem born no be you dem born Another Christmas don come outside for corner o For papa Nkechi meeting dem don carry money run Contribution woman her number no de go Now if you come my area dem de fight comot roof Cause mama Nkechi say she no fit do am with nama o If no be turkey or chicken everybody de wahala o I taya oo Is this the birth of Jesus Christ? Wahala o Na Jesus dem born no be you dem born I de go my mama place o (I de go) I de go see mama o (I de go o) I de go Christmas (I de go) Make dem give me plenty better things make I carry go Onwa December n'orubego (I de go) I de go see mama o (I de go o) I de go Christmas (I de go o) Make dem give me plenty better things make I carry go Is not a do or die Na Jesus dem born No be me and you dem born!
Writer(s): Ifeanyibema Evans Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out