Lyrics

The time don come for me to talk Before I talk make I thank everyone For the support you na give my family During our troubles you my friends Una dey with me Ninety-seven I shall never forget Ninety-seven The pain, the sorrow, the stress I want to thank you my friends I want to thank you my friends Jigbolo! Jigbolo! Jigbolo! Jigbolo! Jigbolo! Jigbolo! Oh yes I remember The day all of us we gathered To pay our respect to the one and only Fela We carry am go him house Before him spirit go for Eledumare Palace I say Together we waka To carry Fela oh For those wey no know Na that day them know Say the people them love Fela oh Together we waka To carry Fela oh From TBS we waka Reach Ikeja waka Seven hours waka Just to carry Fela Together we waka To carry Fela oh The young and the old The strong and the weak The rich and the poor Them gather to carry Fela Together we waka To carry Fela oh And then we want start to relax We no know our problems just start From no where we hear Cousin Fran just pas Just like that she die We start to wonder why Enough is enough The people start to talk The problems don too much As we start to relax Again and then suddenly we hear Na the matter of my sister Sola Come make all of us weak for body Again we asked ourselves why For she was too young to die As we dey cry na so we dey try We dey struggle to save our life The doctors themselves them dey lie Them want to get money to survive The thing wey dey pain me pass Na the way she suffer before she died Na so them dey cut, cut Dey ccMaking experiment with human life Ninety-seven, ninety-seven, ninety-seven Oh! My sister Sola oh! Oh! Oh! Ninety-seven, ninety-seven, ninety-seven I shall never forget Ninety-seven My sister Sola Ninety-seven Jigbolo! Jigbolo! Jigbolo! Jigbolo! Jigbolo! Jigbolo! Oh yes I remember
Writer(s): Olufemi Anikulapo Kuti Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out