album cover
Grace
1
Afro-Beat
Grace was released on November 25, 2022 by Draqula's empire as a part of the album Never Too Late - Single
album cover
Release DateNovember 25, 2022
LabelDraqula's empire
Melodicness
Acousticness
Valence
Danceability
Energy
BPM99

Credits

COMPOSITION & LYRICS
Oyenekan Michael Opeoluwa
Oyenekan Michael Opeoluwa
Songwriter

Lyrics

Omo na him grace
Omo na him grace
Tell me tell me now
Wetin I gain if I no thank Jah
Many don die
Me I de I de live life
I no too special
Na him grace just de cover me
They for don murder me
They for don paste my obituary
I de thank God for his grace
Na him grace no make me fail
Every morning I de pray
Make him just de bless my way
I de thank God for his grace
Na him grace no make me fail
Everywhere morning I de pray
Make him just de bless my way
Awe no de live your life to please anybody
Because na one life dey
If you de live your life to please anybody
Na on your own you de
And dem go like to see you de live in their shadows
Omo them go take you play
Protect your values and thank God for the little wey you get o
Because you be somebody too
Somebody too
I de thank God for his grace
Na him grace no make me fail
Everywhere morning I de pray
Make him just de bless my way
I de thank God for his grace
Na him grace no make me fail
Every morning I de pray
Make him just de bless my way
No lies
I have been through a lot for this life
All my life
I've been fighting and fighting
No lies
E get as e be
Na hin de make pastor de go shrine
Nkan to ju ti ri
No be today we don de rough am
But we still de alive
We de struggle and hustle for day and night
If the money enter we go chop life
And if the money go down we go try again
Everybody different o
No come de lose hope because of little delay
Thank your creator for where you de
B'cause many people de wish to de where you de
I de thank God for his grace
Na him grace no make me fail
Every morning I de pray
Make him just de bless my way
I de thank God for his grace
Na him grace no make me fail
Every morning I de pray
Make him just de bless my way.
Omo na him grace o
Na hin de make me de shine shine
I say na him grace o
Na hin de make me de shakara
Written by: Oyenekan Michael Opeoluwa
instagramSharePathic_arrow_out􀆄 copy􀐅􀋲

Loading...