Music Video

Featured In

Credits

COMPOSITION & LYRICS
David Yahaya
David Yahaya
Songwriter

Lyrics

See I be that boy wey nobody they send for street That boy wey they hustle and dey beg for love That boy wey go shock you anytime I burst Thank God him dey find me anytime I lost oo Oluwa open the way oo Because nah only you fit handle my case Oluwa open the way oo I still dey wait I know the hustle go pay Nah one life man pikin get so I got to live it right Nobody fit rush me nobody fit pay the price I know say my time go come 50-50 life nah dice Cause nah money wey boys dey expect them dey use survive I never reach anywhere yet still dey give the sacrifice I just respect myself a lot some people say nah pride You never feed me before still on still I dey survive I hold ground youself you know I be like something wey them plant But thank God say God no be man Cause if nah so I for still dey on demand But hold yourself if you dey feel say you dey mad Even if I give you blueprint you no go fit know my plan I looked my neighbor in the eye told him I can Why you dey there dey beef come over make we align Eyes up face down submarine mode all the time Abhi you no dey hear This hustle go pay oo See I be that boy wey nobody they send for street That boy wey they hustle and dey beg for love That boy wey go shock you anytime I burst Thank God him dey find me anytime I lost oo Oluwa open the way oo Because nah only you fit handle my case Oluwa open the way oo I still dey wait I know the hustle go pay He that lives by the gun will die by the gun But the gun dey my house so it's living with me No be tinko tinko like childs play But man gas to think o think o the right way I just want to make my future better Living well mama smiling the boy making cheddar I heard your song it's nice but when will you drop another Commot for road before I jam you this stupid okada Man no go shiver You say I been dey fear cause I dey shake forget nah fever High spirit all the time like say I get high fever Temperature high cause you know I keep it a hundred degrees Ginger chock me like I said in lemon pepper shey now you believe Nah on Jesus we dey run am all the time Sweet and sour lemun tsami nah so we dey run the grind Oluwa dey my front and back so if i fall i go still stand Him no dey dull my nigga This hustle go pay oo See I be that boy wey nobody they send for street That boy wey they hustle and dey beg for love That boy wey go shock you anytime I burst Thank God him dey find me anytime I lost oo Oluwa open the way oo Because nah only you fit handle my case Oluwa open the way oo I still dey wait I know the hustle go pay
Writer(s): David Yahaya Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out