album cover
Myself
2,260
Worldwide
Myself was released on June 16, 2023 by Cot Records as a part of the album God and a Beast
album cover
Release DateJune 16, 2023
LabelCot Records
Melodicness
Acousticness
Valence
Danceability
Energy
BPM168

Music Video

Music Video

Credits

PERFORMING ARTISTS
Beepee D Rapgod
Beepee D Rapgod
Performer
Sec
Sec
Performer
COMPOSITION & LYRICS
Beepee D Rapgod
Beepee D Rapgod
Songwriter

Lyrics

[Intro]
Mehn, this song is all about myself
Homie, just listen, I no care if you go like am sef
It's a cool boy thing
Ladies and gentlemen
Cool boy on the beat
[Verse 1]
Ah, people go always make me blame myself
Sometimes I no dey even understand myself
The life wey I dey live, no be me give myself
So, if I never make this money, I no do myself
Don dey love music since the year I was twelve
Book of covers, okwu nwoke, shey you remember them sef?
Everywhere wey e dey bang, people dey like am sef
Bro, I dey try so I no fit come and kill myself
Sometimes, I go just dey, dey vex for myself
Cos the only enemy wey me I get na myself
I tell myself the truth, no dey hide skeleton for my shelf
And na wahala anytime I disobey myself
Oh Lord, wetin I don do to myself?
I don fall in love with me, now, I can't stop loving myself
I don tell myself say I go always dey proud of myself
Now, anything see me do, I just dey do for myself
Ahn, me I no fit overlook myself
Cos I see star any time I look myself
Many things wey I sabi na me teach myself
So, if them no feel me, like lizard, I go feel myself
So many times I dey hail myself
Cos I no fit use wetin people talk dey stress myself
I don pass many tests and I don fail some sef
But wetin I know be say me I no fit fail myself
[Chorus]
I do this for myself
I carry my cross and I face my fears
Nobody go do am for me
Na only me on this journey
I no fit kill myself
When nobody love me, I love myself
I no go do pass my power
Mirror on the wall, I'm a king, Mufasa
Yeah yeah yeah
[Verse 2]
Ahn, make I tell you something about myself
I no dey like fight, I always respect myself
Talk is cheap, so my gee, I gats express myself
But if you throw blow, me I go defend myself nah
I no fit do and overdo myself
I no fit do pesin wetin I no fit do myself
Buh no be say I dey form holy, I no good myself
Na say oil dey for my head, I gat dey crude myself
Like high current, I'm electric myself
Forget their format cos me I don get the trick myself
Wetin man sew, e go wear, I chose fabric myself
I know I'm solid cos na me wey mould the brick myself
I no fit owe you cos I owe myself
And you no fit say you know me pass as I know myself
N'ime ogbe sef, mụnwa kpasịị anya zoo myself
Maka na i mee isi akị oyibo, men egbuo mma sef
Ahn, na God dey bless, I no fit bless myself
Buh before God go begin help I gats to help myself
Sometimes I dey comot before I even dress myself
To make this money make mumcy stop to dey stress herself
Mumcy, my love for you I can't express am sef
Buh heaven know say me I love you as I love myself
Sorry for all the stress wey you been dey go through for my sake
You be the woman wey love me pass as I love myself
Ahn, enwerọọ m ike inenị mmadụ sef
Ọ sọ yị bụlụ carpenter na-akụ sọ table na shelf
Maka na mụnwa amarọọ ife ga-eme echi even for myself
Ebe onye nzọpụta ụwa mesịị wee bụlụ nnwa Joseph
Ahn, na akịdị amarọọ oke ana abụrọọ maka fence
Ọ kwa Igbo tụlụ ilu na passing six abụrọọ passing sense
Na why I always ask question, make I dey clear myself
Cos I dey like understand wetin me I hear myself
Brada, don't say I'm high cos na me high myself
And you're welcome to my world if you go like am sef
You love good music, lemme introduce myself
I'm Beepee D Rapgod, Igbotic Tupac sef
[Chorus]
I do this for myself
I carry my cross and I face my fears
Nobody go do am for me
Na only me on this journey
I no fit kill myself
When nobody love me, I love myself
I no go do pass my power
Mirror on the wall, I'm a king, Mufasa
Yeah yeah yeah
[Outro]
I do this for myself
When nobody love me, I love myself
I no go do pass my power
Mirror on the wall, I'm a king, Mufasa
Written by: Beepee D Rapgod
instagramSharePathic_arrow_out􀆄 copy􀐅􀋲

Loading...