Credits

PERFORMING ARTISTS
BRIYT TINO
BRIYT TINO
Performer
Erigga
Erigga
Performer
COMPOSITION & LYRICS
Bright Idhigu
Bright Idhigu
Songwriter
erhiga agariubie
erhiga agariubie
Songwriter
PRODUCTION & ENGINEERING
Heze Chris
Heze Chris
Producer

Lyrics

[Verse 1]
No put yourself for pressure wey go make you go block road
Or scatter people pleasure, bigman party go cut gold
'Cos instagram be like football, we just dey watch highlights
No be the full 90minutes, e go too long to post
If them say make you drop your problem, make I drop my own
I swear to God, na only you go pick your own run
For area back then, I sabi use my phone take loan
I believe in my one plus one, I no sabi beg
But treasure no won know, put herself for yeye pressure
Abusive boyfriend, not because of yeye pleasure
Take console herself with, e better to cry for benz
Than to tie pikin for back dey cry for keke
Her friends lifestyle na dey burst her head
She won do birthday, her boyfriend no fit burst her bread
Enter instagram, her bestie don post her car
When her boyfriend buy her, pressure getting worser
[Chorus]
Gbadura mi
Olorun, gbadura mi
So many things wey my eyes e don see
Gbadura mi
[Chorus]
Gbadura mi
Olorun, gbadura mi
So many things wey my eyes e don see
Gbadura mi
[Verse 2]
The journey of a thousand miles Starts with a step
Na only god dey know Who go be the next
Steady on my ten toes Me i no go dey relent
I only do my best Na god go do the rest
Many many tears wey eyes don shed My shirt don tear
But I don't care, zero fears
I dont care
You can’t compare
One man army shey you get the idea
I dey my dey
You dey your lane
I dey see youe issues brother I dey feel your pains
I dey wish you well One day we go make it rain
Many battles happening I know say we go win
Rome wasn’t built in a day
But me no dey like the delay
Rome wasn’t built in a day
Baba God bless me today
[Chorus]
Gbadura mi
Olorun, gbadura mi
So many things wey my eyes e don see
Gbadura mi
[Chorus]
Gbadura mi
Olorun, gbadura mi
So many things wey my eyes e don see
Gbadura mi
[Outro]
Gbadura mi (Pray for me)
Gbadura mi (Pray for me)
Gbadura mi (Pray for me)
Gbadura mi (Pray for me)
Gbadura mi
Olorun, gbadura mi
So many things wey my eyes e don see
Gbadura mi
Written by: Bright Idhigu, erhiga agariubie
instagramSharePathic_arrow_out

Loading...