album cover
Iya Basira
31,644
R&B/Soul
Iya Basira was released on January 1, 2006 by Styl-Plus Music as a part of the album Expressions
album cover
Release DateJanuary 1, 2006
LabelStyl-Plus Music
LanguageEnglish
Melodicness
Acousticness
Valence
Danceability
Energy
BPM186

Music Video

Music Video

Credits

PERFORMING ARTISTS
Styl-Plus
Styl-Plus
Performer
Big Mouth
Big Mouth
Vocals
Zeal Onye
Zeal Onye
Vocals
Snappy
Snappy
Vocals
COMPOSITION & LYRICS
Shifi Emoefe
Shifi Emoefe
Lyrics
Tobi Flames Ojowa
Tobi Flames Ojowa
Songwriter
PRODUCTION & ENGINEERING
Zeal Onye
Zeal Onye
Producer

Lyrics

This na one buka wey I dey like to go
The food sweet sote e go make your mind blow
day and night Iya Bas how she do am I no know
They think say na jazz, my broad no be so
People people make una come o
Iya Basira e don jazz me o, ooo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop ati my mother or my girlfriends place
People people make una come o
Iya Basira e don jazz me o, ooo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop ati my mother or my girlfriends place
Long throat na food go kill you (No be so)
I say na food go kill you (Oga mi no be so)
Weytin dey be say e get one day wey I say I go play go see my paddy Sunday
Na so I reach there but Sunday e don high on beer
Luckily for me him junior broad eye e clear
He say make we stroll to the areaittle did I know that I was strolling to my burial
Right there were oshodi bus dey load
Was a little buka close to the mainroad
I laugh when e pass the door
E tell me say hin name na Iya bas for short
But I bow when e order
Iwesiatewa, ero mm purewater not even mineral
I come gree say I go manage to chop am
Before I realize I dey order second round
Third round, Forth round
I never still stop
Weyting Iya Basira e give me chop ehn?
People people make una come o
Iya Basira e don jazz me o, ooo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop ati my mother or my girlfriends place
People people make una come o
Iya Basira e don jazz me o, ooo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop ati my mother or my girlfriends place
Long throat, na food go kill you (No be so)
I know, I say na food go kill you (Oga mi)
You think say na play when I say na the way wey I dey (weytin do am) e no day ok
Weyting be your own advice, I don dey steal my paddy money to buy Iya Basira rice
Even on my girlfriend birthday
When she dey wait make I take am to Ocean View
I no know when I pass the place
The only thing wey dey my mind na Iya basira palm oil stew
Ah!
Kilon kilon shele shele
Me I never see this kind juju, telle telle
All those wey go vex kpele kpele, but I hear say Iya Basira na
I sure say still I go go there go sidon
Order my first round move to second round, third round forth round I no dey ever stop
Weyting Iya Basira come give me chop?
Mo gbeee
People people make una come o
Iya Basira e don jazz me o, ooo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop ati my mother or my girlfriends place
People people make una come o
Iya Basira e don jazz me o, ooo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop ati my mother or my girlfriends place
Officer abeggi follow me to the place
Everybody don telli me I dey craze
My girlfriend don leave me
my mother no gree see me
My paddy mm!
Iya basira e don kill me
Officer abeggi follow me to the place
Everybody don telli me I dey craze
My girlfriend don leave me
my mother no gree see me
My paddy eey!
Iya basira e don kill me
Oya people, people make una stop officer e don come
Where the woman?
Hin dey inside, (oga I dey come)
Woman na weyting u dey give people chop
Wey dey cause all this wahala, casala oya make we talk
Oga sir true to God,
Nothing wey I dey put for the food wey I dey cook
Na God dey make am good.l
Na which kind talk be that
Say na God dey cook the food
Abi u think say I be fool no be juju u dey put
Infact I dey suspect say na ... you wash put
Sote people dey queue come dey rush for your stew
Well to confirm am bring am make I chop small
Give me fufu 90 naira plus that soup wey dey draw
Chaii correct this food sweet no be small
Shey una no go vex if I still order for more
Officer no worry na the food be this
Oya people, people make una go,
case dismiss
People people make una come o
Iya Basira e don jazz me o, ooo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop ati my mother or my girlfriends place
People people make una come o
Iya Basira e don jazz me o, ooo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop ati my mother or my girlfriends place
People people make una come o
Iya Basira e don jazz me o, ooo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop ati my mother or my girlfriends place
People people make una come o
Iya Basira e don jazz me o, ooo
Everybody helep save me o
I no dey sabi chop ati my mother or my girlfriends place
Written by: Shifi Emoefe, Tobi Flames Ojowa
instagramSharePathic_arrow_out􀆄 copy􀐅􀋲

Loading...