album cover
19 something something
24
Afro-Beat
19 something something was released on July 21, 2024 by Kvngs Empire Records as a part of the album Action
album cover
AlbumAction
Release DateJuly 21, 2024
LabelKvngs Empire Records
LanguageEnglish
Melodicness
Acousticness
Valence
Danceability
Energy
BPM104

Music Video

Music Video

Credits

COMPOSITION & LYRICS
Frozy Opute
Frozy Opute
Songwriter

Lyrics

Alarm nor reach your side?
I go wear am 500
If I wear am 500
Oboy I no dey laugh o
Aaactionnn!!
Na since 19 something something
Na hin we dey fight
Thesame people wey tell us say
Make we stand for our right
Dem push us go left
Go right
But still we dey smile
Now everybody no know say their talk na lie
I say nobody know o
Nobody know
Wetin dey happen say nobody know
I say nobody know o
Nobody know
How e take happen say nobody know
Now you want make I show love?
Make nobody tell me one love
You see the way things dey go rough
The masses dey complain e too tough
If no be popo, na the sojos
But everybody know who dey do most
If you de leave house
You gats still know say
No guarantee say you go reach home safe
Aye oo, agh mogbe oo
The average man dey see gebge
Mo ni kilode oo, aghh mokun oo'
How I want take feed my kele?
I say nobody know o
Nobody know
Wetin dey happen say nobody know
I say nobody know o
Nobody know
How e take happen say nobody know
I say we do not want no crisis
Why try to punish us for your sins
The people dey beg
De waka with leg
Hunger hold poor man pikin for neck
We just dey look and our eye dey red
Wetin man fit do to chaw daily bread?
Aye oo, agh mogbe oo
The average man dey see gebge
Mo ni kilode oo, aghh mokun oo'
How I want take feed my kele?
Aactionn!!
Na since 19 something something
Na hin we dey fight
Thesame people wey tell us say
Make we stand for our right
Dem push us go left
Go right
But still we dey smile
Now everybody don know say their talk na lie
Their talk na lie
Know say their talk na lie
Written by: Frozy Opute
instagramSharePathic_arrow_out􀆄 copy􀐅􀋲

Loading...