album cover
Agaracha
679
Music
Agaracha was released on March 7, 2025 by HillView as a part of the album According To Brother Nwachukwu
album cover
Release DateMarch 7, 2025
LabelHillView
Melodicness
Acousticness
Valence
Danceability
Energy
BPM95

Credits

PERFORMING ARTISTS
Prinx Emmanuel
Prinx Emmanuel
Performer
COMPOSITION & LYRICS
Prinx Emmanuel
Prinx Emmanuel
Songwriter
PRODUCTION & ENGINEERING
Prinx Emmanuel
Prinx Emmanuel
Producer

Lyrics

[Verse 1]
E be like say this house don boring
And I for like go taste the water wey dey flow for the foreign
Wait! I no hear wetin anybody tell me
I don book my flight oh, I dey waka for morning
[Verse 2]
Pale man, shebi you know the matter?
Come wire my aza
Because I don pack my akpa
Pale man oh, shebi you know the matter oh?
Come wire my aza
Because I don pack my akpa
I dey move
[Bridge]
Make nobody call my phone
Make nobody disturb my peace oh
[Verse 3]
I don ja, jakpa
I don land
I put call
A few boys and many many girls
E don calm
Money come board
Party don start
We jollof
We lulux
We pop
We dey chop
I dey throway the money, I no dey care
Dollar dollar mint, e ey for my system
[Verse 4]
(And if I dey around oh)
We dey jaiye to pieces
(And we no dey care)
Plenty money dey and e no dey finish
(Say we dey jaiye to the early morning
We dey jaiye to pieces
Plenty money dey and e no dey finish
[Bridge]
(Much, much, mcuh later)
(Insufficient funds)
Sapa oh, sapa oh
[Verse 5]
Aye, e don be
Many many things my eye don see
All of my guys don dagbo me
Oshimiri don swallow me
Na so I put call
E dey ring, my men no pick
E don cut
One day oh
Two days
Three days
I never chop
Carry my last card
Enter road
In search of sure odd
Kpa kpa kpa
The sure odd
E no sure
E don cut
[Verse 6]
Omor, I dey roast
My slippers e cut
I dey waka ten toes
See my eye don red
And it's not a clear coast
And me I cannot continue to dey form Boss
As e don be like this, na to call my old boy
(Na to call the man)
Whether I go fit come house come be one of the boy boy
[Verse 7]
Aye e don tay well
I no sure say the man go pick
Oh my God
(Hello)
Hello
Daddy it's me, Chinonso
Eh eh eh, Chinonso nwa m
Eh Daddy
Where are you?
Where are you?
It's okay, it's okay, it's okay
Daddy I'm coming home
Okay, okay, okay
[Chorus]
Agaracha don dey come back
Agaracha don dey come back
Agaracha don dey come back oh
Written by: Prinx Emmanuel
instagramSharePathic_arrow_out􀆄 copy􀐅􀋲

Loading...