album cover
Grateful 2.0
1
Music
Grateful 2.0 was released on June 6, 2025 by Vybez HQ as a part of the album Grateful 2.0 - Single
album cover
Release DateJune 6, 2025
LabelVybez HQ
LanguageEnglish
Melodicness
Acousticness
Valence
Danceability
Energy
BPM93

Credits

PERFORMING ARTISTS
Jahborne
Jahborne
Vocals
COMPOSITION & LYRICS
Arinze Iheme
Arinze Iheme
Songwriter
PRODUCTION & ENGINEERING
Arinze Iheme
Arinze Iheme
Mixing Engineer, Producer

Lyrics

(Already know)
(I just want to thank you)
(Already know)
(Jahbizzle)
God na your boy from Isolo again
This time I dey thank you
For the sunshine and rain
I give thanks for the oil for my head
Na you dey my side when e been red
Na you dey butter my bread
Na everything wey I want I dey get
And if bad belle stand in my way
Dem must collect
Because whom Jah bless
Wallahi no man test
Dem still dey call their juju for my matter
But e no dey connect
Na your blessings wey dey follow me
You prepareth a table for me
In the presence of my enemies
Your rod and staff comforts me
You no dey ever fall my hand
(Oh yeah)
I dey wonder
Wetin I do to deserve all these blessings
I dey flex everyday now
Because your blessing cover me
I'm feeling grateful
(Grateful)
For all that you've done for me
For the food on my table
(I'm so grateful)
For all that you've done for me
I'm feeling grateful
(Grateful)
For all that you've done for me
For the food on my table
(I'm so grateful)
For all that you've done for me
I'm feeling grateful
Started from the gutter now we here
Before before
To make it to the next day
Na garri we dey soak
Remember dem days
When I get one pant and one shoes
Remember dem days
When we dey carry empty belle go school
But nowadays
No stressing steady flexing
If you know me you know person
Na be say I holy pass my brother
The blessing just dey follow
E just dey flow like water
My own don better
The grace too plenty
Dem think say I be ritualist
So when dem see my doings
Dem dey think say na jazz
Na prayer be my key
Baba God na my herbalist
Every trap wey dem set
Me I dey jump and pass
(From the trenches)
Now we don dey flex overseas
The haters dey online
Dey monitor the steez
**** please
(Back then)
Back then
Dem no rate us
Right now their papa
I just wanna thank you
Through the highs and lows of life
We no give up
We still carry on
So why I no go thank you
Somebody need to tell me wetin I do
To deserve all these blessings
The goodness and mercy
Wey dey follow me
I'm feeling grateful
(Grateful)
For all that you've done for me
For the food on my table
(I'm so grateful)
For all that you've done for me
I'm feeling grateful
(Grateful)
For all that you've done for me
For the food on my table
(I'm so grateful)
For all that you've done for me
I'm feeling grateful
Written by: Arinze Iheme
instagramSharePathic_arrow_out􀆄 copy􀐅􀋲

Loading...