album cover
Unlock
album cover
Unlock was released on November 19, 2025 by Adebowo sing as a part of the album Unlock - Single
November 19, 2025
LabelAdebowo sing
LanguageEnglish
BPM
Melodicness
Acousticness
Valence
Danceability
Energy

Lyrics

Unlock!!!!
Oooooo
Unlock!!!
Yeah... Adebowo Sing
Na life we dey talk here, no be competition
No key fit lock destiny wey God don design
Unlock!
I say, eni ti o ni patience, e ma ṣe race
'Cause time go tell, no be mouth dey chase
Wahala no dey finish for this place
But still, we dey smile with grace
Omo, I remember when e red for me
No light, no hope, no bread for me
Dem laugh say "music go dead for me"
But now, dem dey stream my melody
Na street I grow, I sabi pain
Na why my line dey cut like blade
I no dey talk too much again
I just dey pray, make my hustle pay
Unlock! Yeee
Make the blessing unlock
All the pain wey we don stock
God go use am build our block
Unlock! Ahh
Omo life no be luck
If you grind steady, no stop
Na your key go shock dem unlock
I see man dey hustle with clean hand
But system still dey cheat am
Na why many turn to street plan
But me, I choose light, I no fit damn
Wetin man go do? survival
We dey pray make we no viral
For wrong reason, omo na trial
Na only grace dey make arrival
E ma se tan eyan, e lo gba tan Aye
No be every smile dey pure like sky
Some fit hug you still want you to die
Oluwa, unlock me no padlock fit stop my way
Enemies wan block me but e clear say na God dey play
See, blessings dey flow steady like river for rainy day
No be who start first dey win, my G, no delay
Unlock! Yeee
Make the blessing unlock
All the pain wey we don stock
God go use am build our block
Unlock! Ahh
Omo life no be luck
If you grind steady, no stop
Na your key go shock dem unlock
Every man get him key
Some key dey short, some dey bend
But if your mind clean, and your hands no dirty
Oluwa go unlock your own door
Adebowo Sing say so
Written by: Adebowo sing Tobi Lawal
instagramSharePathic_arrow_out􀆄 copy􀐅􀋲

Loading...