album cover
Abegistan
album cover
Abegistan was released on February 7, 2026 by WeGlobe Entertainment as a part of the album Abegistan
ReleasedFebruary 7, 2026
LabelWeGlobe Entertainment
LanguageEnglish
BPM100
Melodicness
Acousticness
Valence
Danceability
Energy

Lyrics

Ehem... ehem...
My fellow Abegistanians
Citizens of the great nation
Where we no dey work
But we dey chop
I address you today
As your President
Commander-in-Chief of Begging
Minister of Bro Abeg
Our economy strong
Our shame don die
To all our citizens
Wey dey text their friends
For every problem
I see you
I hail you
Our national anthem na
Anything for the boys
Our currency na
I go pay you back
Our flag na
Screenshot of empty account
Together we beg
Divided we still beg
God bless Abegistan
Lekki stree boy, no job, no plan
But your phone dey hot texting every rich man
Davido I fit see 1 million from you
Abegistan
Wizkid abeg small thing make I pull through
Abegistan
Burna Boy remember me from back in the day
Abegistan
Obi Cubana anything you give I go take
Abegistan
You dey slide in DM of every celeb
Your finger don tire but your shame don dead
You post Benz wey no be your own
Screenshot lifestyle, you dey live on loan
Cubana Chief Priest help your boy nau
Abegistan
E-Money anything wey you drop I go chop am
Abegistan
Zlatan Ibile we be day one remember
Abegistan
You no know them but you claim say you member
Abegistan
I no be World Bank o
I no be Dangote
My account no be ATM
Wey you fit come press
Abegistan, population plenty
Abegistan, dem no dey ever empty
Abegistan, visa free entry free
Abegistan, but you no go collect from me
Abegi-Abegi-Abegistan
Country wey dem no dey ever work with hand
Abegi-Abegi-Abegistan
Send your request, I no go even understand
I need a man wey go buy me hair
Abegistan
I need a man wey go pay my fare
Abegistan
I need a man wey go rent my flat
Abegistan
I need a man for this and that
Abegistan
Your IG bio say you be CEO
But your account balance dey below zero
You want Benz man but you no get bicycle
Your spec too high but your hustle too little
I need a man wey go feed my family
Abegistan
I need a man wey go fund my jollof party
Abegistan
I need a man wey go buy me iPhone
Abegistan
But what you bring your own self to the throne
Abegistan
You dey collect collect but you no dey give
You want soft life but you no wan live
Your hand dey out every single day
Independent woman wey no fit pay her way
I no be Central Bank o
I no be Otedola
My salary na my salary
E no be your matter
Abegistan, population plenty
Abegistan, dem no dey ever empty
Abegistan, visa free entry free
Abegistan, but you no go collect from me
Abegi-Abegi-Abegistan
Country wey dem no dey ever work with hand
Abegi-Abegi-Abegistan
Send your request, I no go even understand
See ehn
Abegistan get many citizens
Make we talk true
E get levels for this country
Political jobber wey no dey do work
Your only skill na to chop and smirk
Honorable abeg remember your people
Abegistan
You promise them light but dem still dey see darkness
Abegistan
Lazy man wey dey sleep till 2pm
No skill no plan but you dey blame system
Bro abeg help me make I start business
Abegistan
Same business wey you start and finish for 2 weeks
Abegistan
Lazy woman wey dey wait for husband
Your mates dey work but you dey form madam
Abeg send me small thing for my upkeep
Abegistan
Thirty years old but your papa still dey keep
Abegistan
Church member wey dey beg pastor
Neighbor wey dey beg neighbor
Cousin wey dey beg cousin
Stranger wey dey beg stranger
My people
Abegistan full
The borders don close
But dem still dey enter
You dey owe Musa
You dey owe Tunde
You dey owe the woman wey dey sell Indomie
You dey owe landlord from last year
But somehow new Jordans dey your leg wear
Abegistan, we know your address
Abegistan, your inbox na mess
Abegistan, you fit relocate
Abegistan, but first go find your fate
Abegi-Abegi-Abegistan
Country wey dem no dey ever work with hand
Abegi-Abegi-Abegistan
No be from me, try another man
This na official broadcast
From the Federal Republic of Abegistan
To all our citizens
Home and abroad
Wey dey beg for breakfast
Beg for lunch
Beg for dinner
Beg for data
Beg for transport
Beg for rent
Beg for life
I salute una
But remember
Abegistan visa don expire
Time to find your own fire
Bro you see my message
Seen
Population minus one
God bless Abegistan
And God help Abegistan
Written by: Collins Omoikhudu Asein
instagramSharePathic_arrow_out􀆄 copy􀐅􀋲

Loading...