album cover
Ada George
374
Hip-Hop/Rap
Ada George was released on February 27, 2026 by Independent as a part of the album Ada George - Single
album cover
Release DateFebruary 27, 2026
LabelIndependent
LanguageEnglish
Melodicness
Acousticness
Valence
Danceability
Energy
BPM

Credits

PERFORMING ARTISTS
Igoraqi
Igoraqi
Vocals
COMPOSITION & LYRICS
Igonda Asor
Igonda Asor
Composer
PRODUCTION & ENGINEERING
Igoraqi
Igoraqi
Producer, Recording Engineer

Lyrics

Ehen, come to the place wey I paste you
Comot your hand no dey take two
Na you I dey talk to, wey you
You no wan gree, you hear word, weigh you
I no wan keep the records na why I dey talk say God go help us
I dey put E for effort, make e no come be in vain, e go wreck us
Them say I no dey update
Omoh e really don tey wey I put on my AirPods
For a while I neva hear some records
I just dey locked in busy dey record
Na lie, the things wey them post online
Na why them no fit influence us
I try, them still tell me say I no try, na which one be lack of effort
I fly, them still tell me say e no fly well, if no be back of airbus
I die if I gree say my way no be way, I no wan try your method
Denial no be the same thing as delay
The way you dey see life so e be marathon race, no be say e be relay
The way you dey see my eyes so, I dey para but no be wetin make am dey red
I no dey like brag but if I gats talk am, I feel like I’m better than the rest
I know you wan drag but if I no stop am conversation go turn argument
I’m living a new life now because sometime in the past my lord wept
I need me a durag ‘cause my hair dey cover my face like duvet
I no dey do back but if I wan do you here I dey do well
I don see things lose trust, if I no trust you first make you no vex
Open my eyes and I see the doors, the way I just dey see visions
We just dey first service make we close first
Ehen, come to the place wey I paste you
Comot your hand no dey take two
Na you I dey talk to, wey you
You no wan gree, you hear word, weigh you
I no wan keep the records na why I dey talk say God go help us
I dey put E for effort, make e no come be in vain, e go wreck us
Written by: Igonda Asor
instagramSharePathic_arrow_out􀆄 copy􀐅􀋲

Loading...