album cover
Man on Fire
1
Hip-Hop/Rap
Man on Fire was released on July 7, 2026 by OMT label as a part of the album One Way Man
album cover
Release DateJuly 7, 2026
LabelOMT label
LanguageEnglish
Melodicness
Acousticness
Valence
Danceability
Energy
BPM130

Music Video

Music Video

Credits

PERFORMING ARTISTS
Maximum OMT
Maximum OMT
Performer
Ekene Joseph
Ekene Joseph
12-String Acoustic Guitar
COMPOSITION & LYRICS
Maximum OMT
Maximum OMT
Songwriter, Arranger

Lyrics

Only Maximum OMT
One Way Man
Eeh!
Make Una Clear Road O
Person Wey Dey Mad Dey Come
Tatata-Tatata-Tata
If You No Dey Mad Small, You No Fit Vibe This Jam O
Oya Leggo
Man On Fire, Tatata
Head Dey Scatter, Tatata
Demons Dey Dance, Tatata
We No Dey Tire, Tatata
Man On Fire, Tatata
Wahala Full Wire, Tatata
Na Who Dey Calm, Tatata
Make We Burn This Party, Tatataaa
Tatata
Tatata
Who Dey Hot Pass?
Na We Be That
My Brain Na Molotov, I Dey Pour Am For Ground O
Anybody Wey Near Me Go Smell Petrol For Mouth O
Doctor Say "Take Drug", I Tell Am "I Be The Drug"
I Dey High On Top My Madness, I No Dey Fall, I Dey Jog
Mama Pray, Pastor Spray, I Still Dey Spray Fire
Dem Dey Call Me Mental, I Say "Yes O, Mental Empire."
I Dey See Shadow Dey Twerk For Night
Dem Dey Follow Me Jam
If You No Dey Craze Reach Here, My Guy, You No Be My Man
Shakabula For Head, But I Dey Use Am Do Legwork
Any Beat Wey Drop, My Madness Go Do Network
I No Dey Fight Person, Na My Brain Dey Fight Me
But Tonight We Turn The Fight To Gbedu Wey Go Scatter Street
Man On Fire, Tatata
Head Dey Scatter, Tatata
Demons Dey Dance, Tatata
We No Dey Tire, Tatata
Man On Fire, Tatata
Wahala Full Wire, Tatata
Na Who Dey Calm, Tatata
Make We Burn This Party, Tatataaa
I Carry My Madness Come Club
Dem Say "Oga Calm Down."
I Tell Dem "Make Una Bring More Energy, I Wan Shut Down Town."
DJ Drop The Beat, My Body Catch Fire
Gbosa
I Dey Do Legwork
The Fire Dey Do Zanku
Kpa Kpa Kpa
Fine Girls Dey Fear
But Dem Still Dey Whine Waist
Dem Say "This Boy Don Kpolongo, But Him Vibe Na Grace."
I No Get Chill
I No Get Brake
I Be Pure Cruise
Even If I Mad, My Madness Still Get Better Moves
Bouncers Wan Hold Me
I Tell Dem "Carry Chair."
Make Dem Sit Down Watch How Madman Dey Tear The Air
Tonight Na Judgment Night
Everybody Go Confess
Say This Jam Don Make Dem Craze
Dem No Fit Pretend
Who Dey Hot?
Na We Dey Hot
Who Dey Mad?
Na We Dey Mad
Who Go Scatter This Place?
Tatata-Tatata
Man On Fire, Tatata
Head Dey Scatter, Tatata
Demons Dey Dance, Tatata
We No Dey Tire, Tatata
Man On Fire, Tatata
Wahala Full Wire, Tatata
From Lagos To London, Tatata
Make We Burn This Party, Tatataaa
E Don Finish?
Nooo
Run Am Again
Tatata-Tatata-Tata
Madman Don Shut Down The Show
If You No Mad Small, Go House O
We No Dey Calm Down Here
O Porrr
Turn The Speaker Till E Catch Fire
Naija Party Don Scatter
Written by: Maximum OMT
instagramSharePathic_arrow_out􀆄 copy􀐅􀋲

Loading...