Şarkı sözleri

Eh Mr biggie man o, Mr poor man o Fellow Nigerians o, sebi una dey hear me o No be wetin dem be talk o This was not what dey promised us o Dem tell us say dem go bring the change o Oh no no, no no As the thing dey go, situation e just dey bad o eh As day dey break things e just dey hard ooo No food to chop, everyday dollar dey rise o See the people don dey cry o+ Oh no no no no Pity for us o, pity for us o Politicians please pity for us o Na beg we dey beg o, see my people don dey die o Please pity for us o, politician please pity for us o Oh no no no no+ I believe in Nigeria with all my life I pledge to Nigeria my country o, with all my heart o Anywhere I go na naija Anything I do na naija, Anywhere I go to naija See my houses na for naija, I invest in my naija, Everything na plan for naija Politician show some love o+ Oh no no no no Pity for us o, pity for us o Politician have mercy on us o Na beg we dey beg o E don dey the thing don dey bad o Please pity for us o Politician please pity for us o Pity for us o Oh no no no no+ Oh naija Iworiwo, Iworiwo, Iworiwo As we sit down dey complain today our gragra e full for our body As we dey for here we dey complain our own e full our body o Search your conscience o We sef we no good try Make we live right oh We sef we no dey try I know say everyday politician Dey steal our money I know say politicians carry our money go oversea People dey die Politician just dey smile o People dey die o Their children dey oversea Pity for us o, Pity for us o Politician have mercy on us oo We don dey die o, Anything we do o Please pity for us o, politician have mercy on us o Oh no no no This is painful oh
Writer(s): Chinedu Nnakwuzie, Inetimi Odon Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out