Lyrics

Oh oh oh Mr. DJ, music no de lie Make we just dey jam as we dey try survive Country hard oh but we go overcome (hard oh) Forget your sorrow, we go overcome Ojoro don dey oh, ojoro don dey but we go overcome Ojoro don dey, ojoro don dey but we go overcome Republic of suffering and smiling Number one capital for poverty, gutter independent 1960 Must corrupt and bad leadership No human rights no justice, poverty dey celebrate terrorism Professor dey work for illiterate, unemployment on the real play Most oga at the top no get certificate Chinese doctors don escape Our health minister no know where them dey God bless our health workers Wey dey represent on the front Nigerians are suffering and smiling It's time for Nigerians to wakeup (wakeup) Biafrans say they wan break up Country hard oh but we go overcome (hard oh) Forget your sorrow, we go overcome Ojoro don dey oh, ojoro don dey but we go overcome (Rapapapapam) Ojoro don dey, ojoro don dey but we go overcome People self dey funny oh ya Them go dey complain plenty oh ya But when e reach them turn oh ya Them self go dey do so corny oh ya O cor cor o cor mi oh ya, our money don grow wings E don fly like labalabalabalan Dollar nah four hundred naira When will dollar equal naira? (next level) Why we dey burrow from China? Just to service our budget, lack of proper direction We need economy revolution If the poor man no go fit sleep I swear the rich no go fit sleep Leaders wey dey share coconut tree Nah their own head wey them go break Guy they say you be lazy youth. election time they go use you Music no dey lie Make we just de jam, as we de try survive Country hard oh but we go overcome (hard oh) Forget your sorrow, we go overcome Ojoro don dey oh, ojoro don dey but we go overcome Ojoro don dey, ojoro don dey but we go overcome Country hard oh but we go overcome (hard oh) Forget your sorrow, we go overcome Ojoro don dey oh, ojoro don dey but we go overcome Ojoro don dey, ojoro don dey but we go overcome People self dey funny oh ya Them go dey complain plenty oh ya
Writer(s): Eedris Abdulkarim Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out