制作
出演艺人
Michealz
表演者
作曲和作词
Micheal Utieyinoma
词曲作者
制作和工程
Beatsbymellow
制作人
Jeff Beats
混音工程师
Babalola Osogbiye
监制
歌词
[Intro]
Picker give loader work
Loader load the work, say funds no drop
Picker dey call loader, loader no pick
When picker jam loader, e load loader
[Chorus]
Que será, será
I don high
Whatever will be will be
No believe wetin I talk, o
The future's not ours to see
Or you fit take am serious sha
Que será, será
[Verse 1]
You no fit advise poor man if you no put small money join
No be Aboki wallet, them dey use save Bitcoin
See currencies dey fly, but some dey Crypto
I don dey dye my hair since the time of Sisqo (Oshey)
Five days I never sleep, I dey inside dey bomb (Boom-boom)
If no be cut one even, Otedola for run (Sporty)
Na money over love, but you say she wicked
No tell me to fear women, na you go trust Benin girls
I know wetin I talk, no put words for my mouth
Na you talk say your babe dey cheatn I only say na fact
You bill me, I block you, na one thing wey I hate
'Cause me, I no dey gym, I dey carry family weight
[PreChorus]
Package your mugu well, o, nobody is holy
Depression don kill person wey dey sell Molly
For where the money dey you talk, say I dey rush?
You don see say waka tire person wey dey purge? Ehn, yeah
I get am before no be property
I no dey fear death the way I dey fear poverty
Tell Kpor Kpor say you get weed, my G
You go know say no be every truth go set you free omo
[Chorus]
Que será, será
Whatever will be will be
The future's not ours to see
Que será, será
Que será, será
Whatever will be will be
The future's not ours to see
You know the vibe now
Que será, será
Say, say
[Bridge]
How e be na my blood
Bro no dey call me blood o
'Cause your blood is in vein
Normally na inside vein blood dey dey now?
Eh, you know, you know
[Verse 2]
Say, no stain me with your blood, o, no turn my white to red
I no dey like boys wey dey catch cruise when I dey chase my bread
Life no be bed of rose, but rose dey on top my bed
What will be will be, but you say e don be when them take your girl
Money be like HIV, nobody dey gree say them get am
Salaam Alaikum Shey, I dey spit flows from Mecca (Salam)
I don take loud, now everywhere don quiet
No dey cap like fool, dey observe men, dey silent
Your girl be like gen as I dey choke her, she dey work (Oshey)
She dey try to take break, I absorb her, she shock
I left my ex and moved on, only fools believe lies
Even time no dey go back anti-clockwise
[PreChorus]
Package your mugu well, o, nobody is holy
Depression don kill person wey dey sell Molly
For where the money dey you talk, say I dey rush?
You don see say waka tire person wey dey purge? Ehn, yeah
I get am before no be property
I no dey fear death the way I dey fear poverty
Tell Kpor Kpor say you get weed, my G
You go know say no be every truth go set you free omo
[Chorus]
Que será, será
Whatever will be will be
The future's not ours to see
Que será, será
Que será, será
Whatever will be will be
The future's not ours to see
Que será, será
Written by: Micheal Utieyinoma

