歌詞

Glory to God Honor to Mary Erhi Oko e don hook u Zaah Anywhere me I dey my guys dey there If u know where my mind dey my guy your mind go dey there U know where I dey come from No go there If I tell u how the matter be u no go like go there Olofofo Na my matter dem dey yarn oh Dem wan see me fail but i dey ball like Ighalo Dem carry my mata for head e be like afro Dem dey yarn apata dem dey talk for my back oh Snazzy still dey trek he never buy car Some say he no dey trek na steady he dey use cab He no dey carry body na why I like am Some say he too dey carry body na why I no like am I be like tortoise I always dey their discussion U know say the story no go make sense if I no dey there Na me dem dey talk about anytime oh Na me dem dey talk na my story wey dey pain dem Life no easy but wey dey package am Street be like breast wey don fall we still dey package am If your girl no fine at all my guy package am If better money come na only you go tiwa savage her Life of a star no be bear Focus on your hustle e no easy anywhere I focus on my hustle my guy the vision clear I don't have to be a prophet to see the vision clear Why always me like balotelli Shey be na me dem dey see now for their parlor telli I gat all eyes on me feeling like makaveli I be like beast for the beat your best rapper dey fear me Chee I no fit rob like zubby micheal I dey use my head yes I dey use my mic oh No go dey do ritual like kanayo o kanayo Kanayo dey do ritual but yet he still dey owe kanayo This Life no balance but I stand gidigba Na time e go take even wizkid wear okirika If to say life Na nollywood I for don make am Na to comot village enter city E no go take time This no be movie na real life Too many girls na hip hop be my real wife Please don't try this at home e no be real life Wetin undertaker dey do dem no dey do am for real life E get some kind of things we no fit talk o Olorun Oba kari aye Some people get the food, them no fit chop o Lord of mercy open my way That's why you gats to low key Omo olope you gats to low key Shout out to all my OGs wey dy ginger me on a daily Na only God wey dey bless person If not for God This hustle for dey stress person Some people talk wan dey vex person But I no dey leave my life to impress person Olofofo dem try to bring me down oh Na hustle I hustle no be fight Olofofo dem try to bring me down oh But if I fall I must to rise Omo wetin dey sup Zaah E get some kind of things we no fit talk o Olorun Oba kari aye Some people get the food, them no fit chop o Lord of mercy open my way That's why you gats to low key Omo olope you gats to low key Shout out to all my OGs, wey dy ginger me on a daily Olofofo dem try to bring me down oh Na hustle I hustle no be fight Olofofo dem try to bring me down oh But if I fall I must to rise
Writer(s): Amraibure Prosper Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out