積分
演出藝人
Erigga
聲樂
詞曲
erhiga agariubie
詞曲創作
製作與工程團隊
Abel Onuche
製作人
Gideon Ituma
製作人
歌詞
[Verse 1]
See, God dey hear all our pain, continue to grind
Abeg no give up, God too big to whine you, guy
Tell me why you wan dey disregard
This na your passion, lock up, everything na time
No be the day dem born pikin e blọkọs dey big
Na small small, bring your mind down, everywhere go gig
No be today you don dey do am, I believe you bro
Na under pressure person dey know the kinda strength e hold
[Verse 2]
No chase wetin no dey chase you, protect yourself
Your mental health, peace of mind, before you wreck yourself
Na na name when you give your pikin dem go call am, no vex
Know your value, world people ready describe am less
[Verse 3]
If God dey bless your neighbor, know say e don near you
No follow them hate who no hate you, use your brain, wey you
Make someone smile, but no forget say you be someone too
No put your power for their hand, set your boundaries too
[Chorus]
Happiness ain't cheap (E expensive die)
Happiness ain't cheap (E expensive die)
The dream too big, no fear say e scary guy
We fit achieve am, lock up, God dey hear we guy
100 milli milli, God dey hear we guy
90 billi billi, God dey hear we guy
The dream too big, no fear say e scary guy
We fit achieve am, lock up, God dey hear we guy
[Verse 4]
God know where e put us from the very start
Deep in the streets, e no dey but we barely starve
Very business minded, we know when to run
Enter the market, cut out, ekelebe dey come
No be the life when we plan, but wetin man go do?
Trek go school, cos who e papa drop no cool?
Stupid life, I wonder wetin we dey think back then
My sister, nothing cool for sapa, japa leave them
Enter Lagos see life, e no tey I loss
When we dey pray blessing, because the lifestyle cost
Overrated or underpaid, which one you like?
E no concern us so far we dey the Eko life
Allow my life inspire you (Na better pot of stew)
The prayer na as we ball make account dey full
We no dey do am for validation, internet dey mad
Na money carry us come here, dey market dey mad naw
[Chorus]
Happiness ain't cheap (E expensive die)
Happiness ain't cheap (E expensive die)
The dream too big, no fear say e scary guy
We fit achieve am, lock up, God dey hear we guy
100 milli milli, God dey hear we guy
90 billi billi, God dey hear we guy
The dream too big, no fear say e scary guy
We fit achieve am, lock up, God dey hear we guy
[Outro]
And so we continue to roll
Lost souls looking for our goals, mehn
Prayer na when money come, heh
Make we see better health take enjoy am, you no understand?
Shoutout to all my **** when dey grind worldwide
Keep grinding, my ****
Who tell you say na 100 meters?
Na marathon oh, continue, no stop
Written by: erhiga agariubie