Music Video

Area to the World
Watch {trackName} music video by {artistName}

Featured In

Credits

PERFORMING ARTISTS
Erigga
Erigga
Performer
erhiga agariubie
erhiga agariubie
Performer
Victor Adere
Victor Adere
Performer
COMPOSITION & LYRICS
erhiga agariubie
erhiga agariubie
Songwriter
Victor Adere
Victor Adere
Songwriter

Lyrics

Abeg! Omo e get weytin i just dey observe ehn for this industry *It's Victor AD nahnah ye e* *It's paperboi* Motivate yourself men Area! The Erigma E pain me say na wen I go na hin everywhere burst People wan know if na true dey check Insta blog Rappers dey throw backie happy wan kill dem die As Erigga no dey again people go feel dem die Even rappers wey no dey post my song before Fake love don put me for their profile picture They screenshot their dm wen I dey write dem Say make we run feature see me see problem Followers don increase go 1.5 m OAP since morning dey jam me for Fm My videos wey soundcity no gree accept Dey on every rotation even my concert Na so e for be but oluwa forbid My song go speak for me anyhow e be Who go better go better na time e go take Day break everywhere burst for goodness sake I say tell dem the full story but dem no dey believe o eh No matter how you watch film d story inside no fit change o I be dey give dem the full load down but but dem no believe o eh Who God don bless world people no fit change o Area o, area o, area o ehh (Warri to d world) To the world o, to the world o, to the world o eh Area o area o area oo eeeh (Paper boy Abeg!) To the world o to d world to d world o eeh I remember wen I no get bar That year na wen I dey de edjeba Madam no meat just put soup with 5 eba No be enjoyment I come na for survival No where to go wetin man go do Na around 2 we dey thief fuel from people motor Dey sell give who get I pass my neighbour Rechargeable lamp dey listen to omadebo As e dey give us gist about celebrities No internet Na him be out everything I remember when I track am for DBS Give am my jam e no play am e pain my chest Because I know d stress wen I don go through No sponsors sef na money why u save for school Na hin I take record am wetin man go do Give up no join abolie sup wit you I say tell dem the full story but dem no go believe o No matter how u watch film d story inside no go fit change o I be dey tell dem the full load down but dem no believe o Who God don bless world people no fit change o Area o, area o, area o ehh To the world o, to the world ehh, to the world Area o area o area o ehn (Abeg! Wahala) To the world o to the world oo to d world Omo see the character Na only time e go take stammerer go call him papa name Motivate your mother*cking self man
Writer(s): Erhiga Agariubie, Victor Adere Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out