Music Video

Lyrics

Hello How far I get gist for you o Ah what's up You know that girl with 20k followers on IG na Which one? That girl that is always shaking her bum bum That is always doing Oh keep popping That girl suppose they carry filter anywhere wey she dey go o Hehe... why na? Omo babanla scam Ehn? Why you too dey talk o? Shey you no dey tire? Ejo e nle njo wey no concern you Na there them go find you You no get work o Na for your mouth dem go hear say Simisola get belle (She don get belle) Na for your mouth them go hear say Biliki dey sell pepper (She sell pepper o) Na for your mouth them go hear am Busy body don come, may you fear am Uncle face your work o Mind your business (Mind your business) Who say make you no mind am (Mind your business) Busy body o (Mind your business) If you no like am (Mind your business) Na lie I no fit lie give you na Kemi Sef dey there I dey there Her makeup don wash finish Nothing to write home about No be that one come pain me passo Na that her boyfriend Well done sir Mr talker Eku ise Mr wetin no concern me reporter Simi don marry Adekunle But why? Was Falz invited? How is that your concem? Why dont you face your work Aunty Uche? You go chook your mouth everywhere like eku te You no dey let sleeping dog lie Sweetheart Shey you know say na curiosity wey kill cat? Leave talk, leave amebo, leave chat Face front Find business wey you fit start Take tea. drink that. mind your biz wax Open your ear when you're listening to this track Na for your mouth them go hear she buy three cars But say she just use her mama do ritual (Amebo) You say Sade just dey reach 32 years But she never still marry, make she do fast Mind your business (Mind your business) Who say make you no mind am (Mind your business) Busy body o (Mind your business) If you no like am (Mind your business) Wait o No be that her boyfriend wey dey give am porsche assurance? Believe you me Wetin I see no be porsche assurance Na Okada assurance Jesus! God save us dear You dey put your mouth Alakori oh! For the thing wey no concern you (thing wey no concern you) Alabosi ooo The thing wey you dey find go find you Mind your business (Mind your business) Who say make you no mind am (Mind your business) No be by force oh (Mind your business) If you no like am (Mind your business)
Writer(s): Simisola Bolatito Ogunleye Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out