Letras

Everyday me i Dey work but i no Dey see result Kida go and make money Omo nah steady insult One short One Pam and only one polo Suffer Dey make man think you go feel say I wan Kolo Boys Dey pull up on a stead God nah when me seff go hot Tomorrow carry belle my tomorrow don go abort Write song Record am hoping say I go blow Beg Mc for slot I fit perform for your show? So many things man face but I'm not a story teller Life do me shina and I no be peller Pick up my call oluwa show me the way All my guys are living large why my own con Dey delay Why Pain in my heart daddy reason your son I Dey work I no Dey sleep why e never reach my turn What's life without the money my guy e no dey sweet Tony moe how far put the chorus on repeat The God I dey serve e no dey sleep If you see me I dey laff I don shed tears for corner Make dem know say The God I dey serve e no dey sleep If you see me I dey laff I don shed tears for corner Make dem know say Good things no dey come easy You gats understand Time and season And if you think say me I lazy I don sacrifice I don side with Jah Person wey no go no fit to know Person wey don go e no dey fear Person wey no go no fit to know oh oh oh oh I tell them before I go blow but nobody believe in me My dreams are too big that nah why dem no believe in me Every hustler with him pay So nah steady I dey work Juju dey fail just put everything on God Money stop nonsense all those people wey Dey hate me Money don show all of dem dey wan relate me Thank God for life Omo now we living large Long life more funds More keys to the garage God's time nah the best so nigga no Dey rush Everything go fall In place you go still fit buy the Porsche Believe in your self and believe in what you do God Dey no Dey fear brother Everywhere go good Cheii Grass to grace One day the story go change Nah time e go take you go pull up in a range If you get update still Dey share am with your friends Only you no fit convoy like get 32 benz The God I dey serve e no dey sleep If you see me I dey laff I don shed tears for corner Make dem know say The God I dey serve e no dey sleep If you see me I dey laff I don shed tears for corner Make dem know say Good things no dey come easy You gats understand Time and season And if you think say me I lazy I don sacrifice I don side with Jah Person wey no go no fit to know Person wey don go e no dey fear Person wey no go no fit to know oh oh oh oh
Writer(s): Kida Wonder Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out