Suggerimenti
Testi
Paper Boy
Eh
Day break everywhere burst
Tell 'em
Nanana Nanana onanana (comot your leg for high tension)
2 seconds
Abeg
One bright morning
I just see say times don change, now time no dey do me
One bright morning
As I start to grow beard beard, fine girls come dey chase me
Them come dey chase
Ayy
E no be as e be before for the thing
Nowadays 12 hours no dey be like half day
Ayy
No be play
Who no go, no go know how e be
Who no hunger no go know say na real
I say them no know o o
I say them no know say
Who no know how e be for the thing
No go know say okpo no be medicine, dem no know (Eh Eh)
Dem no know
Say
Konji no be sickness
Okpo no be medicine
Ayy
Konji no be sickness
Wayo wayo wayo
Okpo no be medicine
I know say them tell you
Soldier go soldier come barrack stand, everybody no shaking
I know say them tell you
As you carry Gara Gara for your head, say, my guy make you calm down
Calm down
Ayy
E don tey we dey kill ourselves for the street
Meanwhile politicians dey fire fire eh eh
Ayy, no be play eh eh
E no be as e be before for the thing
Nowadays SARS vex, them fire fire eh eh eh eh
Ayy, we too dey play eh eh
Who no go, no go know how e be
Who no hunger no go know say na real
I say them no know o o
I say them no know say
Who no know how e be for the thing
No go know say okpo no be medicine, dem no know (Eh Eh)
Dem no know
Say
Konji no be sickness
Okpo no be medicine
Ayy
Konji no be sickness (paper)
Wayo wayo wayo (bwai)
Okpo no be medicine (old Warri in the building)
Abeg
See
This one hunger dey hold us like power holding
If e burst my brother na ritual loading
Money come fame come, everywhere burst
But when you go, wetin you and baba God go talk?
This fame you dey see so, be like babe wey fine
Till you doke am, your head go dey shake like palm wine
Who no go no know
Nobody tell me, na when I enter e clear like HD telly
See, everything we sing for TV na lie
The money dey but e no too dey like that walahi
All the dollars we dey hold for videos na fake
Cars and mansions na people own we take dey rake
Even the vixens we no dey carry them go house
But Warri go say Erigga that your video blast
Shake my head, paddle my canoe dey go
Who no go know unless wetin dem tell am yo (eh)
Who no go, no go know how e be
Who no hunger no go know say na real
I say them no know o o
I say them no know say
Who no know how e be for the thing
No go know say okpo no be medicine, dem no know (Eh Eh)
Dem no know
Say
Konji no be sickness
Wayo ayy
Okpo no be medicine
I say
Konji no be sickness
Wayo wayo wayo
Okpo no be medicine
I say eh eh
Konji no be sickness
In that case ayy
Okpo no be medicine
I say
Konji no be sickness eh eh
Wayo wayo wayo
Okpo no be medicine
Writer(s): Kehinde Peter, Richard Achimugu
Lyrics powered by www.musixmatch.com