album cover
ABRAHAM
album cover
ABRAHAM è stato pubblicato il 7 ottobre 2026 da Gaza Province Inc. come parte dell'album ABRAHAM - Single
7 ottobre 2026
EtichettaGaza Province Inc.
LinguaEnglish
BPM115
Melodicità
Acousticità
Valence
Ballabilità
Energia

Testi

Lagos traffic don hold Soso
Who go come take my pain away
Inside cell I don beat kodo
2iC no Dey cross my lane
High on coda I Dey Sotovo
I no Dey hear when Dey call my name
Virgin Mary I need a favour
A billion dollars for my pain
Me wey Dey give hope to many people why I go come Simmer down
I don't really have no fun while spliffing I Just wan stay alive
Too many spoons Dey for my table dem wan chop Ofada rice
I can't really say no to this people na me be their Abraham
Me wey Dey give hope to many people why I go come Simmer down
I don't really have no fun while spliffing I Just wan stay alive
Too many spoons Dey for my table dem wan chop Ofada rice
I can't really say no to this people na me be their Abraham
I no look left & right again
I don puff Jombo size aye
I don Dey overthink am Again
Can somebody save my soul Amen
I no look left & right again
I don puff Jombo size aye
I don Dey overthink am Again
Can somebody save my soul Amen
The kain load wey I carry
see I swear e big pass me
When you talk about your trauma
I Dey laugh cus e Dey muzz me
Abi you don see am kolo kolo when Appear shoot person
That kain thing I don see am before before
So your Glock e no Dey fear me
I need God to liberate my soul
Too dangerous the life I chose
Only me know how I walk in my shoes
Only me know where e Dey pain me gan
I'm reminiscing the lies I told
Went outta my way just to get this bread
Too many times wey my man dem fold
Too many times wey my man dem stand
Lagos o Pourthacourt o
Os o Cana cost o
T pain o pity us o
Jesus o help us o
lexus o brabus o
less talking actions o
they thought they could tame us o
attack o vinicius o
I no look left & right again
I don puff Jombo size aye
I don Dey overthink am Again
Can somebody save my soul Amen
I no look left & right again
I don puff Jombo size aye
I don Dey overthink am Again
Can somebody save my soul Amen
Written by: Emmanuel Chibuike Emeri
instagramSharePathic_arrow_out􀆄 copy􀐅􀋲

Loading...