album cover
Request
album cover
Request은(는) {albumName} 앨범에 수록된 곡으로 2022년 8월 20일일에 G9 Activated에서 발매되었습니다.God's Speed - EP
2022년 8월 20일
라벨G9 Activated
언어English
BPM
멜로디에 강한 음악
어쿠스틱 악기 중심
발랑스
춤추기 좋은 음악
에너지

가사

Yung Papi
Ahh! Major
It's Graham D D D D baba now ah
On the beat, it's C Major
Ah, one time for the people wey e dey for me yard
Everybody don too dey para
Everybody want to blow now
Two times for the hustlers, all of them wey dey for me yard ah
Obi go to school nah
No, Obi wan be Cubana
Mummy oh
This thing e no funny oh
I don dey work, I dey work, I dey hustle, but things e no dey get better
Oh, why me oh
My pastor tell me oh
Make I no worry, say God e get billions for me, for the future things go better
So, God abeg, give me small money
From the billi billi, wey you keep for me for my future
So, God abeg, give me small money now
From the billi billi, wey you keep for me
Oh ah ah
My request oh
God abeg, abeg, abeg
My request oh
Abeg, abeg, abeg oh
Owu wan be my friend, no let am
God abeg oh
Abeg, abeg, abeg oh
No let owu come be my friend, uhh
Abeg, abeg, abeg, no let am
Life show me fire, fire, shege
Hunger wire wire me
Time dey waka waka
Money no dey, so I gats do kanyamata
Boys don para para
Carry laptop kpata kpata
E no dey work, dey enter baba babalawo side
Dem come do saka sakawa
If the money fit just dey for me now
Everybody go enjoy from me now
I don dey think to do something funny now
God abeg do something for me now
I no fit thief, I no fit cut person head
Else, me I for don use Amina
But, me I no get that kind liver
So, God abeg, deliver me oh
So, God abeg, give me small money
From the billi billi, wey you keep for me for my future
So, God abeg, give me small money now
From the billi billi, wey you keep for me
Oh ah ah
My request oh
God abeg, abeg, abeg
My request oh
Abeg, abeg, abeg oh
Owu wan be my friend, no let am
God abeg oh
Abeg, abeg, abeg oh
No let owu come be my friend, uhh
Abeg, abeg, abeg, no let am
Wicked Mix
Ahh! Major
It's Graham D D D D baba now
Written by: Nzeh Graham Onyemike
instagramSharePathic_arrow_out􀆄 copy􀐅􀋲

Loading...