Credits
PERFORMING ARTISTS
Efe Money
Performer
COMPOSITION & LYRICS
Efe
Songwriter
Victor Ufuoma Thompson
Songwriter
PRODUCTION & ENGINEERING
Raynstorm
Producer
Lyrics
Uhn!
Na for car I sit down dey write this verse
I drive reach house finish NEPA take light gen no gree start
Serviced apartments non-serviced apartments Lekki don cast
But the irony omo be say nobody gree pack
[Verse 1]
Back to the matter
Na pain and agony full my mind
My palm dey sweat as I dey write I no dey feel alright
My mama say for this life men, nothing is given
You gats to work hard even when you fail, you keep it pushing
So when I see bad comments for my page I dey wan cry
Sometimes e dey hook me reach neck like say I dey wan die
How dem go say
I no sabi rap my music dey wack
When I don dey shut down many shows all the way from J’town
I carry on now dem dey believe dey lick am like pronto
And na my house rent I use make this EP run the promo
And I go borrow, even more cos I believe in me
Against All Odds na my story that’s the seed in me
[Verse 2]
Uhn!
Same year when we make the cheddars
Na the same year when we lost Al’Chaddaz
Dem write me off till their ink finish
Now when dey see me all of dem dey wan dey speak English
[Verse 3]
Uhn!
Joy dey full my mama eyes men when she look at me
She dey see her proud son growing men, and e dey buga me
Mummy I just wanna say to you I’m grateful
Would have never turned out this great at all men if it wasn’t for you
I nor forget my Papa
Daddy you be too much man
The love wey I get for una e be too much man
Just so you know I’m a product of the grace of God
And na success go dey follow me against all odds
[Verse 4]
Mi ke se ke rere
Mi ke se ke rere
Ochuko meh
Mi kpe vwowe
Mi ji ruvwe
[Verse 5]
Woruno Doh
Woruno Doh
Ovie Doh
Ovie Doh
Ovie Doh
Jesu Doh
Jesu Doh
Jesu Doh
[Verse 6]
Ovie Doh
Ovie Doh
Ovie Doh
Jesu Doh
Jesu Doh
Jesu Doh
[Verse 7]
Mi ke se ke rere
Jesu Doh
Jesu Doh
Jesu Doh
Written by: Efe, Victor Ufuoma Thompson

