Music Video

God No Go Shame Us (Gngsu)
Watch {trackName} music video by {artistName}

Featured In

Credits

COMPOSITION & LYRICS
Lionel Tamunokworo
Lionel Tamunokworo
Songwriter
PRODUCTION & ENGINEERING
Large Beatz
Large Beatz
Producer

Lyrics

ClassicB one finger in the air mehn Make you no shame us oh Make you no shame us oh Make you no shame us oh God no go shame us Make you bless me Ooh make you bless me Oh ah oh ahn Baba God make you bless me I no want my guys to dey flex me As dem dey order I wan follow dey order I no want another man to come dey oppress me Poverty be like Goliath I be David with the catapult God give me block so I go fire am E no go bad If I make this money So anytime mama ask me I no go waste time to dey wire am Oluwa dem say we no go make am we don boil water I know you go bring the garri make we make am I no be guy man wey get open eye But e go bad if another man use tinted glass carry my woman pass me For broad daylight knowing say I no go fit see am Even if I open eye I stay woke like olosho For Casablanca this hustle we use buy boxers one day we go use am buy car Baba God make you bless me I no want my friends to dey laugh me Every morning in the night I dey go on my knees Baba God make you bless me Make you no shame us oh Make you no shame us oh Make you no shame us oh God no go shame us Eledumare na which day you go answer me Abi angel Michael no dey show you the missed calls Dem say money is the root of evil but you dey ask for 10 percent tithe Does it mean that you are evil Naaaah Na money naim dey give joy If offering no dey involved some pastors for no dey go church I wan dey get money Dey pay my tithe so anytime I ball church So Pastor go dey smile pray for the boy I no wan be poor man w ey dey frustrate Dey tell small boys for the street anything for your boy Bible talk say wetin you believe naim go work for you Hustle until teacher wey been dey flog you start to work for you Matthew 7 7knock it shall be opened I don dey knock since Oluwa abeg break the padlock I know say I be sinner Bless me for my Mama no want make society use me As example of bad luck like the woman in the Bible with issue of blood Until you bless me God me I no fit let go the matter be like you be yahoo boy And I be SARS If you no bread me how I wan take let go Baba God make you bless me I no want my friends to dey laugh me Every morning in the night I dey go on my knees Baba God make you bless me Make you no shame us oh Make you no shame us oh Make you no shame us oh God no go shame us Who sell plantain today fit own plantation tomorrow Who hawk bread today fit buy the bakery tomorrow If you give your brother update no mean say you sef no go cash out They took my umbrella forgetting that my God can stop the rain No be say we no sabi short cut oh but we no wan ball for 5 years come go 6 feet This hustle be like marathon and I don tire Like banny wey dem knack anyhow my legs dey shake Oluwa abeg run am for me When I think of the kind life I wan live sleep dey comot from my eyes Naim make I dey hustle Make my call no come be like noise I no wan dey shout opor when my guys dey pop champagne Cos your name dey Tunde you wan dey do giveaway like Tundeednut But your mama never chop you be Tunde wey head knock Hard work no be by power na by grace Dangote no fit carry him bag of cement Stop praying for your enemies to die If you don't want to bury friends Cos na your cartel go wan knack your girlfriend Hustle oh cos nobody be your best friend Family no fit cross street to support your dreams But dem fit travel miles to come chop your burial rice But you know wetin go sup? God no go shame us (AT ALL)
Writer(s): Lionel Tamunokworo Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out