Lyrics

Mama pray, mama pray My head ooh, my head ooh Mama pray for me, pour oil for my head Your pikin don dey go, make I go well If I dey crossroad, make I cross well If I wan carry kele, make I carry well If I jam crossroad; make I pick well When water scarce, I go see well Make I hear bell, when trouble dey road Sapa hold others, e no go hold me As I dey leave home, to go feed home I no go call home, say I no fit feed oO Many years from now, na from grass to grace Rags to riches, come friends and Bentleys Mama pray, mama pray My head ooh, my head ooh Mama pray, mama pray My head ooh, my head ooh Mama pray for me, pour oil for my leg Your pikin don dey go, make I waka well No go waka go, where I no suppose go Olopa dey pursue, make I run well Fence dey my front, I go fly well If dem dey East, make I dey West If dem dey North, make I dey South When them dey down, I go dey up If dem dey dessert, make I see dam See my hustle pure, but them no send Them wan collect my own, con go sleep well Them no go breathe well, them no go sleep well Mama pray, mama pray My head ooh, my head ooh Mama pray, mama pray My head ooh, my head ooh Mama pray for me, disturb God for me When December come, I no go cover face If I come house again, I no go trek again All hustle na bargain, make we see gain If we no feed the fam, wetin we gain? Make we see sun, make we fit ace For daytime, we go see sun When the night come, we go still see sun Any path I take, make baba pave am Any call I make, make baba link am Any track I make, make the DJs play am! Make the people love am! make the city rock am! Mama pray, mama pray My head ooh, my head ooh Mama pray, mama pray Mama pray, mama pray My head ooh, my head ooh
Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out