album cover
Try
164
Afro-Beat
Try was released on August 22, 2025 by CHUKIE HAUZ ENTERTAINMENT as a part of the album A Different Mindset
album cover
Release DateAugust 22, 2025
LabelCHUKIE HAUZ ENTERTAINMENT
Melodicness
Acousticness
Valence
Danceability
Energy
BPM199

Credits

PERFORMING ARTISTS
Oga Network
Oga Network
Vocals
COMPOSITION & LYRICS
Evans Onyebuchi Ifeanyibema
Evans Onyebuchi Ifeanyibema
Songwriter
PRODUCTION & ENGINEERING
Banana Boy
Banana Boy
Producer

Lyrics

You Dey try and you deserve a hug
You dey try
Na Wetin mummy talk
But if results never really come
You never try enough
Rice weh him body never hot nor fit turn jollof
She say pikin try till it is enough
She said go and face your fears
Cus no one cares
No love here
Until you've done enough
Na better tomorrow dey my mind
key to open am dey my hand
If I go by myself fall my hand
Ohh na my bad
Run am run am
Dey sofri dey run my race
Run am run am
Na better tomorrow man dey chase oo
Run am run am
Dey sofri dey run my race
Run am run am
If better tomorrow dey your mind run am
That's same cage
weh make fowl come dey form for hawk
Na that same cage
them take hold am until e enter pot
She say pikin nor let hand fall
She say nor go stop
because say them never do am before
Motto don break down taya I still dey fix am oo
I still dey patch am oo
As I dey go town oo
Na so I dey fall down oo
Battery weh I take dey go na so e run down oo
Everybody on him own na who go charge am oo
The race e personal na why I run am oo
Na poverty make me see risk embrace am oo
Run am run am
Dey sofri dey run my race
Run am run am
Na better tomorrow man dey chase oo
Run am run am
Dey sofri dey run my race
Run am run am
If better tomorrow dey your mind o run am
Na better tomorrow dey my mind
key to open am dey my hand
If I go by myself fall my hand
Ohhhh na my bad
If I nor put in my best
Tomorrow morning go come
If I nor dey proud of myself
Na who I go blame?
Written by: Evans Onyebuchi Ifeanyibema
instagramSharePathic_arrow_out􀆄 copy􀐅􀋲

Loading...