Lyrics

Tetu, where you dey go Wetin you dey go Wetin you dey find Why u dey ask me that kind question Say where I dey go You don hit my car, oyinbo repete I say, you don bash my car, gbese repete Tell me, you don hit my car, oyinbo repete As you don bash my car, gbese repete Wetin you dey find Where you dey go As I dey walka dey go like so Me, I am looking for this paddy This paddy owe me plenty money They tell me say they dey ikoy Me I get (yidis) for one party Seri Paddy yen, ofe pa mi Today na today, no time for story Tinba dele re, Ti n gba mu He must pay me all the money I come reach him say I come see say People gather dey just dey cry I try to know wetin cause the cry They tell me say my paddy don pai As I con dey go back to my house I come meet small hold up for road The next thing wey I hear for my back Na one scratch from another car Ehn Ehn You don hit my car, oyinbo repete I say, you don bash my car, gbese repete Tell me, you don hit my car, oyinbo repete As you don bash my car, gbese repete See, me see trouble ooh, another day again Dead body no dey pay person money Another paddy don dey bash my car Today na today, no time for story Ah, Eedris, na u, see wahala Hey, whatsup, Tony, whatsup man Ebe long time, wey no see, whatsup man Ol boy, stop that yarn o Wetin be whatsup You bash my car, you dey tell me say whatsup Shey na whatsup I go use spray my car I beg pay me my money Police con come dey measure the line They say make I no worry, everything go be fine They turn the papers say I make sign I sign my own, Eedris sign im own I con dey whether who get the fault They say na my paddy get the fault o I pack my car, see trouble Yanga dey sleep, trouble come wake am He he You don hit my car, oyinbo repete I say, you don bash my car, gbese repete Tell me, you don hit my car, oyinbo repete As you don bash my car, gbese repete Huhh Somebody o, somebody wey You don kissin ni, bobon kolo Shey na girigiri you dey take drive car Shey is good Somebody wey were, bobon kolo fit kolo Begin dey drive car ka kai kai Don kolo, girigiri Another wahala to carry for head Money no dey pocket for man to spend One of my paddy wey dey owe me money I reach im house, they say he don pai Another don dey bash my car Wetin I go do, e no get money I con think say this stress no worth am Today be na own, tomorrow fit be my own I go tell my paddy Make he come dey go Help me to push my car from road As I push am small, wetin I see Na government car come bash my car Again You don hit my car, oyinbo repete I say, you don bash my car, gbese repete Tell me, you don hit my car, oyinbo repete My own don better o, owo repete You don hit my car, oyinbo repete My own don better o, owo repete Tinubu, you don hit my car, oyinbo repete My own don better o, owo repete Tinubu, you don hit my car, oyinbo repete My own don better o, owo repete Tinubu, you don hit my car, oyinbo repete
Writer(s): Bongo Boys Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out