Lyrics

You are all welcome to the Gene6ix of Snazzygrin The EP is all about Snazzygrin Na hustle get the Mula no be your 32 teeth I hustle warri tire I even trek 32 street I dey perform for free show wey dem no dey pay me Mc go still dey collect the small money wey dem spray me But I thank God for my life I dey reach the place wey I dey try go Mumsy dey pray for me make I blow like Pablo I no be small pikin for the game I be senior man So if you come from Benin ogbeni pray make Epa blow Put your face for banner show promoter go deny you Dey see Lukaku and Pogba for game still dey ask who be MAN U But me I dey hustle Charlie I no dey mind you Me I don dey blow I just dey remind you Aah ah aah aah ah aah Aah ah aah aah ah aah Aah ah aah aah ah aah Aah ah aah aah ah aah Lord listen to the words wey I wan utter I know say I be sinner I no deserve to dey your alter For this life I don too suffer Make you bless my hustle this year money go suffer I know so many people wey promise and fail me But I thank God for God wey dey for me he no fail me Them write number for Instagram say them go sign me I call them back later them say wetin concern me Them be like Snazzygrin just tell us the reason why you no dey do G I no be man wey dey like ogbeni I no dey do G Snazzygrin don dey make am naim dem know Na But nobody care to know wahala wey the boy be face oh Aah ah aah aah ah aah Aah ah aah aah ah aah Aah ah aah aah ah aah Aah ah aah aah ah aah Aah
Writer(s): Prosper Amraibure Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out