Lyrics

Jimi dey vex, he come dey shout (O ti ya werey) For Marwa roundabout (Kilo wi) Mr. Jimi dey follow okada shout (You dey mad oh) For Marwa roundabout, hey Jimi wa motor, biggy biggy motor Jimi olowo, he just win the lotto So, he put a brand new range on the titi But on that same day Something happen for Lagos For Surulere Bode Thomas Biggi gbege e don burst Wey nobody go fit stop Something happen for Lagos For Surulere Bode Thomas Biggi gbege e don burst Wey nobody go fit stop One man reverse, he commot him shirt The fight e tough, who go come to settle Dem just dey para, dem dey curse their self Your mouth dey smell, na sense you no get Nobody near leave us to flex Shey you want to test you go learn your lesson Hold my shirt you want dey flex Who born you sef Tell me who is mad now Today, today we go do the smackdown Shebi we go kuku enter one trouser Shey you say you no go stand down Omo you go tell me who dey mad now Today, today we go do the smackdown Shebi we go kuku enter one trouser Shey you say you no go stand down Hold me, oh, hold me, oh Hold me, oh, hold me, oh I fit to shey werey gan for here (You never see anything) E for better make dem hold us, oh E for better make dem hold us Somebody stop us Maybe call police and try to report us Some people stop but dey just want focus I no know say person fit kolo like this, oh (Baba yi ni were gan) Na this person wey drive this Jeep, oh (Hey o ga o) Na when this Danfo dey commot my street, oh (Kurombe) Wey he just take speed enter that Jeep, oh Yepa, he don buy market Instead to relax make he try quiet He want still dey show that he have madness He don't know madness e pass madness (O ma shey o) Something happen for Lagos For Surulere Bode Thomas Biggi gbege e don burst Wey nobody go fit stop Something happen for Lagos For Surulere Bode Thomas Biggi gbege e don burst Wey nobody go fit stop One man reverse, he commot him shirt The fight e tough, who go come to settle Dem just dey para, dem dey curse their self Your mouth dey smell, na sense you no get Nobody near leave us to flex Shey you want to test you go learn your lesson Hold my shirt you want dey flex Who born you sef Tell me who is mad now Today, today we go do the smackdown Shebi we go kuku enter one trouser Shey you say you no go stand down Omo you go tell me who dey mad now Today, today we go do the smackdown Shebi we go kuku enter one trouser Shey you say you no go stand down Hold me oh, hold me oh, hold me oh Hold me oh, I fit shey werey gan for here Hold me oh, hold me oh, hold me oh Hold me oh, I fit shey werey gan for here
Writer(s): Inconnu Compositeur Auteur, John Oche Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out