album cover
One Day
album cover
One Day was released on September 24, 2026 by Jtwice as a part of the album One Day - EP
ReleasedSeptember 24, 2026
LabelJtwice
LanguageEnglish
BPM100
Melodicness
Acousticness
Valence
Danceability
Energy

Lyrics

Aya eh aya eh ah eh
Aya eh aya eh ah eh mmmm
No matter how the story goes
Nothing fit stop it oh
My matter for public oh
One day we go make am by force
Except say dem kill God oh
Heaven bare me witness oh
Cause I dey grind everyday one time
One time, one time
Say dem wan hear mm
Dem wan hear many things
Dem wan vibe
Me I no fit loose any patience
Me I go wait for my time
I no go stop
Until me I realize (Aya eh)
Looking at my neck
Me I go see better ice (Aya eh)
Praying to God
Just see the sun rise
Oh my music go dey sell for pump price
The boy wey leave mama house oh
Must to see food to chop oh
The boy wey leave home to feed home
Must see food to chop oh
Cause I be E-Money
Wey no get money
Tony Elumelu
Wey no get bank account oh
I be Adenuga
Wey no get how to glo
I no go give up
I just gats chase on my dreams oh
Cause one day e go be
One day e go be mm
I no go give up
I still gats chase on my dreams oh aii
One day e go be
One day e go be mm
I no go give up
I still gats chase on my dreams oh, dreams oh eh
Shey me I must turn up
Na the same boy wey dem lock up oh
Na the same boy wey leave mama house
Carry him bag to Lagos aii
Shey me I no pompous oh
I dey stay cool and focused oh
As I dey run my race
Make dem no use their reggae
Come spoil my style plus oh
I no go stop
Until me I realize (Aya eh)
Looking at my neck
Me I go see better ice (Aya eh)
Praying to God
Just see the sun rise
Oh my music go dey sell for pump price
The boy wey leave mama house oh
Must to see food to chop oh
The boy wey leave home to feed home
Must see food to chop oh
Cause I be E-Money
Wey no get money
Tony Elumelu
Wey no get bank account oh, chai
I be Adenuga
Wey no get how to glo
I no go give up
I just gats chase on my dreams oh
I be Obi
Wey sapa just dey hammer oh
Omo I be chief priest
Wey no get shrine oh aii
Poco Lee
Wey no come get shoe to dance oh
Omo I be Sabinus
I no come get teeth to laugh oh
Don Baba J
Written by: Udoka John Ordu

Loading...