Lyrics

Rain weh fall for harmattan Cassava suppose value am o But monkey nor wan know who plant banana Na banana consign am ooo Sheh them say if e reach mouth e go reach belle Wetin come go Dey vex belle when e reach mouth Help me ask belle I wan know Wetin vex belle Ahhhh ohoho haaaa Rain Dey beat us Sun Dey beat us Hand Dey meet us Government hold the thing weh go help us Them nor Dey give us Human Being and open eye Hawk and fowl Dey one market o Dey buy things dey put for one basket o Dey hug each other Dey share blouse and skirt For here I nor know who be who She tell her mama say she Dey go fight for her right Cus since them born her government never treat her right She nor know say she go d*e that night Because the order weh them give na sh**t on sight Honorable minister who dey off my mic Na all these kind talk una nor Dey like Una love loyalist weh go lick una yansh But deep down una know say all una regime na trash Rain Dey fall instead of umbrella you give me broom Even the umbrella weh you give me na gone too soon Money dey miss set up panel oko don dey fa*nt From the look of things devil go first una repent How you go say the IG live weh I watch nor real But snake swallow millions make I believe abii But put am for your mind say this generation different We just Dey wait for the right time make Una prepare We Dey come
Writer(s): Evans Ifeanyibema Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out