Music Video

Snazzygrin Ft Keeda Xpensiv - Wahala Dey (Official Audio)
Watch {trackName} music video by {artistName}

Credits

COMPOSITION & LYRICS
Prosper Sunday Amraibure
Prosper Sunday Amraibure
Songwriter

Lyrics

Heh Oko e don hook you Snazzygrin Na my name joor oh You're welcome to my gallery This na back then when I dey for school I see many bad things but my eyes dey for good Bros I rugged am just acting cool No go call me Abubakar oh am just Atiku Army beat me for wetin I no know boy Before dem soak me for gutter I no know boy Dem even beat me forget Popsi number But I know say OLUWA no dey sleep he no dey slumber Trust nobody no believe man Like a Reverend sister no believe man Na my Paddy set me up I no believe man Me I no be runs girl so why I go believe man I never die now dem dey share my property Dem poisoned milo for me I think say na proper tea I still drink am I no leggo Life with Christ too sweet I no fit leggo But I sick for many years I be like Job oh Blood of Christ no be the same thing with Zobo Life whiteout Christ be like hushpupi without Gucci Na 3 wise men see the star no be Mushi You're welcome to my gallery I was crucified like the cross of Calvary 30k for Kissdaniel no be Salary Boys dey do G World wide u know the salary You're welcome to my gallery I was crucified like the cross of Calvary 30k for Kissdaniel no be Salary Boys dey do G World wide u know the salary Omo I tire for the matter Na Life too hard you know the matter Na Ogbeni life hard you know the matter So you wey dey hustle use your head like Morata I no fit talk wetin I pass through I no dey lie wetin I dey talk e no fit pass truth I spit the truth on the mic i no fit lie put The mic no be vita foam so why I go dey lie put Old man teeth wey taba spoil no be for toothpaste For this life I gat many things to face No think say na everybody like you Even innocent no like 2face You say life hard how you plan your own Ogbeni work hard you too like vasa You dey eye Gucci you dey eye Versace you no wan work oya tell me how you wan take buy Versace You're welcome to my gallery I was crucified like the cross of Calvary 30k for Kissdaniel no be Salary Boys dey do G World wide u know the salary You're welcome to my gallery I was crucified like the cross of Calvary 30k for Kissdaniel no be Salary Boys dey do G World wide u know the salary Everybody just dey ask where I dey I no hide oh I dey where I dey But truly if you wan know where I dey Ogbeni look your face you go se where eye dey
Writer(s): Prosper Amraibure Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out