Lyrics

Sound sultan, naija ninja Kennis Music Na for all ma brothers wey don ja commot for naija always try to dey look back because there's no place like home Yknawmean? Yoruba man tell me say Ajo o dabi ile And na true men Check this out Ajo o dabi ile No matter where u go make u no forget area o area o Na naija Ti ode ba tile Pada wale o wale o How I wish say I fit reach u anywhere u dey, u dey Far away, that one no say make u dey bone area o Mother landi o na your area o Chinedu somebody borrow you ego Make you take travel go chicago Remember Nnamdi sell him car So you go go America All these people wey bin dey raise you still dey stay for face me i face you promise say u no go fashie them every other month u go dey tashi them Hillary wey u been promise to marry Still dey wait ol boy she don tarry When she see u na inside Ovation You marry Oyinbo from another nation Use mago mago get dough Now your Oyinbo wife don't know next thing you know she don go report you Wetin you know them don deport you You been say na one year E come turn to two years You don go for seven years But You dey serve eleven years Even when your papa pai Plus the tears your mama cry Bayo for chicago o Dem dey miss you for Okoko o Biodun for Canada Your mama still dey wonder Igba wo lo to ma pada o Remember for naija you get iyawo Ko dabi ile (5 times) Ajo o ma dabi ile o You say u go call Everybody wait tire for your call Rote o, why u go like so o? From germany, to carry coco enter Yankee but then coco burst for your bele Rest in peace. You fly away How come one day wey fun dey u fit come backi o Your papa landi o I understand sey u been so far away Long long way from home (4 times) You got a long long way from your papa land Think before u enter that plane All ma brothers in the west, south, east, north south U know how we doing it And all these people wey dey rule us Make una try make naija sweet Make we get water, light e.tc. So that people go dey come house Kennis Music All the cardinal points Respect All ma people in da house
Writer(s): Fasasi Olanrewaju Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out