Lyrics

I hope you're listening Story I wan yarn you no be story for the gods Story I wan yarn you na true story of course Story I wan yarn you no be story for the gods Na true story of course It all started from when he came out from his mama belle Them dey use bare foot waka for street, when they no be Cele Though growing up wasn't easy as a little boy Grew up on the street, not like some of all these city boys They say without the hard times, story no go sweet Hard time don too much, story don dey turn diabetes A journey to a thousand miles begins with a footstep As no money to enter bike, trekking was his first step I soak garri, soak garri sotay garri don dey soak me Hustle for the street of lagos and for pure water company Before popsi find me he help me go salanka You wonder wetin man pikin go find go salanka Something lead to something, I go tell una the matter A nigga named Amako show me how the street be So paddi I don jassi no body need to gist me Amako take me as his boy Before I gradually knew, my papa pikin don dey spoil I don dey do drugs, just to multiply my shoe racks Few months later, the prison yard become my new house We be strangers, so popo forget about these ones Lowkey inside prison we spend about six months Deportation camp, now I don begin dey hustle Just to cash out I turn slave to my neighbours 'Cause person no fit use empty pocket go back to Lagos Change location to Cotonou I'm about to know If God dey exist or we just living under the moon I work for Amako and en brother with little pay for Few months later on we living the life that we prayed for Prayed for The life that we prayed for
Writer(s): Mizzy Banks Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out